04/07/2023
This EU people should go and focus on their problems. Leave Nigeria alone.
TINUBU DON REJECT THE REPORT WEY EU BRING FOR 2023 ELECTION
Nigerian Presido - Asiwaju Bola Ahmed Tinubu on Sunday say him dey reject the report sey the European Union Electoral Observer Mission don arrange after the 2023 presidential election. Him con talk say na cabu cabu report wey just small group of people siddon do.
The statement according to wetin Mr. Dele Alake wey be the Special Adviser to Tinubu on Special Duties, Communications and Strategy, say the “jaundiced” report no get weight as the EU no even reach 50, say dem no cover all the states, talk less of all the wards and polling units wey dey Nigeria.
Tinubu say around May, this year, dem raise alarm give Nigerians concerning the plan of some Oyibo people from different countries wey dia plan na to come “discredit” the presidential election wey the Independent National Electoral Committee (INEC) don conduct. Him say “that time we bin no mention diabname but we make am open-dential say dis Oyibo people no wan stop to dey put fire for our electoral process as if our country no dey sovereign enough or get power to organise oursef. Dia major target na the candidate of the APC.
“E dey burst our head say for this generation, oyibo people go dey still dey come tell us wetin we go dey use dey measure our election and say if we no use the one dem talk, then our own no clear”. No be juju be that? “We dey knack our chest to talk again say the last presidential election for Nigeria wey Asiwaju win, na’im be the most credible, peaceful, free and the best election wey Nigerians don organize by dem self since 1999”.
Make we remember say top top organisations like the Nigerian Bar Association (NBA) some religious organizations both Muslims and Christians and even most African countries don commend the outcome of the election.