29/10/2025
W/ Owo Ernesto II & Okiemute Ruth Bello
Senate Presido, Senator Godswill Akpabio don blame women say na dem cause why women no dey plenty for government. E talk say women no dey vote for their fellow women, na men dem dey always vote for during election.
Him still talk say di gender wahala still dey strong for Nigeria politics, even though women almost be half of di people wey dey vote, dem no still get better number for parliament compared to other African countries.
Minister of Works, David Umahi don talk say President Bola Tinubu government don start new level for road construction wey go last between 50 to 100 years. E say dem wan end di old style of bad and short-lived road projects.
- Wetin una get to talk about this matter?