Ernest Pidgin News

Ernest Pidgin News We breakdown news for a living.

"My salary land yesterday, as I see alert, I run go meet my husband, ask am how much him need make I drop after I don te...
01/03/2024

"My salary land yesterday, as I see alert, I run go meet my husband, ask am how much him need make I drop after I don tell am say my salary don show.

Oga think say na joke, e talk amount wey big well well, thinking say I go vex because e be like say na all my salary. I just carry my phone do transfer give am. E shock am like film. I come pay our children lesson teacher salary so that e go free hin mind.

Na there I come sabi say my husband dey try well well without noise. E dey see am as hin responsibility, even when wahala too much, e go still pay without dey ask me. E shock am well well, e happy. I know say my money na small part of wetin e dey bring but e feel like say I give am millions.

I come yarn am say I dey hustle well well to bring more money so that e no go too dey stress. I assure am say I no be burden, I be helper and e suppose dey feel more relaxed pass when e never marry.

I never feel say I deserve to chop person pocket and I no go start with my husband. Omo, oga waka go market without tell me, e carry load house. E cook, serve me sef. This small support don settle silent quarrels wey I no even sabi about. I go dey work harder and dey do my best. Men too need support, dem no be supermarket. Men need our support too."

Ukraine model, Anastasia Pokreshchuk, wey carry hersef go do surgery wey make her cheeks big, don yan wetin she dey find...
24/02/2024

Ukraine model, Anastasia Pokreshchuk, wey carry hersef go do surgery wey make her cheeks big, don yan wetin she dey find for man.

For interview wey she get with DailyMail, she talk say her ideal man go need get money and dey always dey available for her. She talk say she no go spend her own money on top her man mata.

"I dey focus on my career, but if I dey in relationship, I no go spend money on top am. E suppose provide, because wetin I need man for? I fit get anytin I want easily!" Na wetin she yan.

Before she become social media sensation, Anastasia talk how e hard for am to get job. She talk say she get small money but she get two options - either make she follow sugar daddy way or make she find job. She come talk say she no wan do sugar daddy matter because e dey uncomfortable for her. She wan get her own job, say her career dey important.

"I dey get plenty strange messages from old men wey wan give me money, but I dey block dem sharp-sharp," Na so she yan.

For how she feel after the surgery, she talk say she wan look mirror, see herself, and say "wow, I fine." She talk say her b***s no dey like boy own again, as she don do 1050cc implants wey make dem perfect.

She add say she do BBL and e be the deadliest cosmetic surgery, but she talk say she no fear. She yan say beauty dey carry pain, and she fit die even if she cross road.πŸ™„πŸ™„πŸ™„

Apostle Chibuzor send me go Dubai, today me and my wife show appreciation with plenty dollars. πŸ˜²πŸ’°"Apostle Chibuzor talk ...
14/02/2024

Apostle Chibuzor send me go Dubai, today me and my wife show appreciation with plenty dollars. πŸ˜²πŸ’°"Apostle Chibuzor talk say human development na the best development, na why I go dey use tithe from OPM Church develop human beings," Apostle Chibuzor yan.

Me: Tomorrow I fit see my doctor check my eye because na only 500 naira notes I dey see.πŸ™„πŸ˜

Address

Ubuchi Street
Owerri
460109

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Ernest Pidgin News posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share