GARRI LORD

GARRI LORD Making things happen πŸ€”πŸ€”πŸ€”πŸ˜΄

Please relax with us here😹😹πŸ₯°WARRI PROVERBS1. Na person wey never see problem dey useEnglish dey pray.πŸ€·πŸΏβ€β™‚οΈπŸ˜…πŸ˜…3. Goat wey ...
26/05/2024

Please relax with us here😹😹πŸ₯°
WARRI PROVERBS
1. Na person wey never see problem dey use
English dey pray.πŸ€·πŸΏβ€β™‚οΈπŸ˜…πŸ˜…
3. Goat wey get mind follow lion go catch
fish, make e know say weda dem catch fish
or not, Lion food don set oh.πŸ˜ƒπŸ˜ƒ
4. Who naked no dey chuck hand for
pocket...!πŸ€—πŸ˜πŸ˜
5. Wetin concern dog with family planning?..πŸ˜’
6.Na determination dey make Okada
overtake trailer for road.πŸ˜ƒπŸ˜ƒπŸ˜…
7. This one good, this one good na em mad
man take dey gather plenty load.πŸ˜’πŸ˜…πŸ˜…
8. Pikin wey go strong go strong.... No be
say until dem name am Samson.πŸ˜πŸ’πŸΏβ€β™‚οΈ
9. Na over confidence make February no
complete.πŸ˜’πŸ˜…
10. Do you know who I am? Do you know
who I am?..Naso hold up take dey start.πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜…
11.Head wey no wan think, go carry load..😁😁
12. Hand wey stay long for pocket, know say
nothing dey that pocket.😹😹
13. Forget Trust If trust dey, Water no for
boil Fish.😹😹
16.No matter how lizard do press-up reach,
e no fit get muscle pass crocodile.πŸ˜’πŸ˜ΉπŸ˜Ή
17. E de clear pimple, e de clear pimple na so
bleaching take start.πŸ™†πŸΎβ€β™‚οΈπŸ˜ΉπŸ˜Ή
18. Feel at home, feel at home na im dey
make visitor spoil remote control.😴😴😢
19. Es**rt me, es**rt me naso slave trade
take start.πŸ™†πŸΎβ€β™‚οΈπŸ€£πŸ€£
20. It's a small world!! No mean say you fit
trek from Naija go London.πŸ˜…πŸ˜…
21. Christianity is free, but you must buy
BibleπŸ€”πŸ˜‚
22. Person nor dey use shame chop winch oπŸ˜‚πŸ˜‚
23.Make I chop this guy money, Make I Chop
this guy money. Na so ashawo take start oh.πŸ˜„πŸ˜„πŸ˜ƒπŸ˜€
24. You no need spoon and cutlery to chop
slap.πŸ€”πŸ˜ŠπŸ˜Š
25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot
2day go dey for top of cooler 2moro.πŸ˜†πŸ˜†
26. The patient dog ... Nah hungry go kill am.😐😐

27. I go do am later na e make fowl no fly
like other birds.πŸ’ƒπŸΌπŸ’ƒπŸΌπŸ˜‚

28. No food for lazy man no be for person
wey em mama get restaurant.πŸ˜ŠπŸ˜…
29. Who dey hold landlord rentage no dey
fry stew wey curry dey.πŸ˜΄πŸ˜΄πŸ˜‚
30. I am covered by the blood of JESUS, E no
mean say make u no lock door sleep ooo

Please follow πŸ™πŸ‘‰Reason well comedy

20/04/2024
06/03/2024

Address

Onicha Ugbo
Asaba
FON

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when GARRI LORD posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to GARRI LORD:

Videos

Share