Blog in Pidgin with Fidelis

  • Home
  • Blog in Pidgin with Fidelis

Blog in Pidgin with Fidelis Hafa? You wan make money abi you no wan make? Follow me now to learn how to make money in Blogging.
(3)

Blog in Pidgin is a page dedicated for Nigerian pidgin english lovers to learn Blogging in more relatable language.

Most people dey run their Arbitrage blogging like this..Traffic Source >> Landing Page >> Their actual Ad or Website.And...
10/05/2024

Most people dey run their Arbitrage blogging like this..

Traffic Source >> Landing Page >> Their actual Ad or Website.

And E con be like say their Landing page dey receive more traffic most times but dem no dey monetize am.

That na why, I write this, because I dey use am monetize mine, atleast extra $1 - 50 daily no bad.

Use my ref link, we both go get %5 extra for you first earnings.

👇👇

You can register easily using my referral link: https://bloginpidgin.com/propush

Earn money from Push subscriptions.

19/01/2024

LINK CLICKS ADS, WHICH OPTION BETTER PASS?

Hafa my people,

E don tey oo, i get una for mind, i say make i drop this quick video, why Link clicks ads no dey work for Una and which one better pass.

06/01/2024

New Video Today!
E don really tey my gees!!

Happy New Year 🙌Make sure to check all post titles on your blog, change those with 2022/2023 to 2024. If you base on SEO...
01/01/2024

Happy New Year 🙌

Make sure to check all post titles on your blog, change those with 2022/2023 to 2024. If you base on SEO, recrawl the post via search console.

2024, let’s be intentional about making everyday count inching towards our goals.

31/12/2023

Why OGs dey always look for Partnerships?

I say my Chook mouth and also ask you, if you be blogger wey get blog and e get search traffic in a good niche oo.

Send me a DM here, make we partner and i go dey give you 20% of everything we earn per month, sharp.

Time to make 2024 your year by simply providing an Adsense account wey the blog dey get many pageviews per month.

Send a DM or email [email protected]

Thank you.

31/12/2023

Got questions, Comment below, i will make video of it. New Video today: "Why OGs like Partnerships with other Bloggers".

28/12/2023

As i dey mention "send traffic" "send traffic" people kon dey wonder, wetin be traffic?

Well, i say make i quickly chook mouth in this quick video about wetin be traffic.

Oya enjoy! Subscribe to various channels of ours oo, so we go dey together.
Press 🫳 https://bloginpidgin.com/bio

28/12/2023

Some Adsense account no dey record clicks today. You dey face same?

25/12/2023

Hafa my pipo 🙌

I throw more light on wetin Adsense arbitrage means, i share some countries and some concepts wen people take dey run am and make money ontop am.

Watch, share and Enjoy, no forget to follow me across various social platforms via Blog in Pidgin /

Hafa my pipo 🙌Una merry Xmas ooo, I wish you and una family a happy and enjoyment Xmas celebration 🎉 Make I kwikly drop ...
25/12/2023

Hafa my pipo 🙌

Una merry Xmas ooo, I wish you and una family a happy and enjoyment Xmas celebration 🎉

Make I kwikly drop dis wan here 👇

No matter how the urge dey, make sure wen running ads, do one country per campaign, if na FB, i country per campaign& Adset.

Dat way you go dey know which dey perform best based on either CPC/CPM and turning off the rest until you get a winning geo wen you go use steady.

Una weldone o,
Who cook rice here?
I dey come!
Until den,
I don mia 🏃‍♂️

25/12/2023

Hafa my people 🙌

I say make i quickly drop this video because e go make am easy for me to also drop one of our Bloggers group whatsapp link where many people dey chook mouth put for Adsense Buying and selling mata.

I go drop the whatsapp group link in the comments!.

Happy Xmas in Advance,
I go see una tomorrow,
until then,
I don Mia 🏃‍♂️

24/12/2023

To make money on ADX dey give peace of mind pass Adsense but to earn ontop ADX na the koko, no be childs play oo. U dey use am?

23/12/2023

Hafa my people 🙌

Today I say make I drop one video oo, na about 12 questions I feel say dey important for anyone to dey ask if e wan dey successful for Arbitrage blogging.

Arbitrage blogging na that type of blogging wen be say you go buy cheap traffic and earn beta money for that traffic.

E.g say you buy traffic of N10k naira to your blog and based on wetin the visitors do, you come make 40k e mean say you make 4x (ROI return on investment)

Well, thank God I don get beta video editor now na Nnamani Uchenna e go make work dey fast, una fit kontact am if una need video editing stuff too.

More videos go begin dey drop now,
until then..
I don Mia….

20/12/2023

Hafa my people!!

E clear abi e no clear?

So today, Abi yesterday wey I make this video,

I just say make I show newbies some terminologies like domain, hosting, DNS and key terminology for Adsense.

I also show various Adnetworks wen we dey make money untop, let dem know say no be just Adsense person go kpai put.

As usual Oya! Watch enjoy, share and make sure say you visit our website via bloginpidgin dot com, there you go subscribe to dey get my email, and link to WhatsApp channel dey the learn more button.

In fact subscribe to all our channels because, I go begin share this videos across all my shosha media akant o.

Until the next one,
E go be, I don Mia.

My people how una dey?Unlike Adsense, these network pays weekly!.Hope una don subscribe to BlogInPidgin YouTube ?Special...
19/12/2023

My people how una dey?

Unlike Adsense, these network pays weekly!.

Hope una don subscribe to BlogInPidgin YouTube ?

Special thank you to all those wen don subscribe, wen dey watch my videos, wen dey share my videos una do well.

Many people say make I put mouth for other networks like Monetag, Adsterra, Galaksion etc.

Don’t worry I go begin do am now!

Check comments for links to register for Monetag now. ⬇️⬇️

18/12/2023

Why newbies suffer with Adsense Arbitrage | 4 Things to Do.

Not just newbies oo, some OGs still dey face one or two wahala oo, some barely break-even but no wam,

I dey for una,

In this video, I share 4 things to for you to be assured of success.

More videos dey come,
Until then,
I don Mia…..

17/12/2023

How to know the kind of Ads every arbitrage blogger is running:

In this short video, which could also be used by e-commerce guys, i unravelled easy steps to know the various Link clicks ads and Messenger ads that competitors and those OGs making $1,000 daily are running.

Enjoy it? As always, share, like and comment to support and motivate me to continually make more videos. Be sure to also subscribe to Youtube Channel "Blog in Pidgin with Fidelis".

More videos dropping,
Until then, i don Mia..
Peace!.

16/12/2023

Yay!!! first video and it’s an unplanned one.

Okay, During the dry run of my upcoming content creation series where I will be teaching you guys how to make money in blogging using pidgin English,

After editing this particular video (myself), I said well, why not just post this till my new videos from my editors starts rolling in— I hope I tried in the edits? I couldn’t just allow the video waste even though I hadn’t taken my bath here or freshened up 😁

I made it while on shorts even 🙈

Switches to pidgin: I try abi I no try?

So my Gee, no time to waste oh, for over 13years na this blogging your man don dey do oo, naim I take put small thing for ground and naim I dey use manage life and my family,

I con say ehen why I no go just kuku begin dey put mouth for this blogging tin make una dey learn small small, e good abi?

Atleast make new ones no make same mistakes wen we make o

So, if e make sense, stay with me, share this page to your friends, carry this our blogging matter for head like your own make we make some dollars together oo

Me sef don tire to hala ‘God when’ na “God thank you” I wan dey hala every month now.

Oya naa until the next video,
I don mia…

~ Fidelis.

Address

Abuja

900108

Website

https://fidelisozuawala.com/

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Blog in Pidgin with Fidelis posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Blog in Pidgin with Fidelis:

Videos

Shortcuts

  • Address
  • Alerts
  • Contact The Business
  • Videos
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share