22/03/2023
LETTER TO MY LANDLORD😂
Dear Able Landlord,
It’s me Okikiola the tenant you gave double
quit notice the other day I don finally pack.
Yes I pack today but I get small confessions
wey I wan yarn you like dis
Ireti your daughter don get belle!
Yes you read that right and na me give am
belle. no vex The way e happen sef I no fit
explain e even shock her sef… we no plan
am like dis. You be my fellow man and I
hope you understand say na accidental
discharge. e fit happen to anybody, but I
promise say e no go happen again.
I for like be ur son-in-law but you’re a bad
man Yes
Bingo your dog no loss na chop we
chop am!
I know say dis one go shock you pass bcoz
we follow you search for am No be only me
chop bingo we dey three Me your
caretaker and one other hausa man
Oga LandLord bingo sweet die I use am
cook soup, cook rice, cook stew, even use
am cook beans Omoh! the dog get natural
oil for body And i know say you go dey
plan to lay curse on me, the curse no go
wrk bcoz I pray before I chop am
I know say I bad, but you see that your
caretaker na evil man. Him get liver collect
the lion share despite say na me bring up
the idea can U imagine
Oga Landlord I know say when U
return from your journey you go dey find
your keke.
The thing be say I sell am dis morning.
Money been no too dey my hand and I
suppose settle one or two agent for this
new compound I wan park into no too reason am
The iron condemn man been dey price am
25k but I say nooo. How I go sell Keke wey
still dey in gud condition for 25k e no good na
So Las Las I come add ur wheelbarrow mke
everytin be round figure So the iron
condemn man com later pay me 30k for
everything Na the money I use transport myself.
I drop 2k under Ur door mat so wen
you come you carry am hold body. E no
gud say I sel Ur property without
dropin somtin my conscience no go
allow me rest So dis na the ones I fit remember for now,
no vex Find a place in your heart 2 4giv me .😂🤣