As e Happen 247

  • Home
  • As e Happen 247

As e Happen 247 as e happen a purely pidgin based news platform that gives you updates on recent happenings around you

02/11/2022

C'River 2023: SDP Deputy governorship candidate takes on PDP State Exco Member on Zoning and rotational politics of Cross River State

15/06/2022
Anambra state goment say dem don destroy one house wey be di hideout of notorious kidnappers for Oba, Idemili South loca...
12/06/2022

Anambra state goment say dem don destroy one house wey be di hideout of notorious kidnappers for Oba, Idemili South local goment area of di state on Friday.

According to di statement wey goment release, security task force bin don raid di hideout recently before dem now demolish di old bungalow building on Friday, June 10.

Di release reveal say dem arrest some pipo and recover some exhibits like locally made pistol, shrine, charms, concoctions, indian h**p, among oda incriminating materials

Recently, kidnappers bin kidnap one state lawmaker wit im aide - dem find im head separated from im body some days later.

Govnor Charles Soludo bin announce ₦10M reward for any one wey fit provide information about di perpetrators.

25/07/2021

Nigerian actor, Actor Victor Osuagwu say no be small trouble e dey face since Obi Cubana bury im mama.

“Since Obi Cubana bury im mama na so I dey see my mama for dream. “

Di actor say if e close im eyes small, na e mama go appear for dream dey shout make e do re-burial for am.

“Where I wan I get money to do re-burial for my mama? I be Obi Cubana?”, di actor ask.

🎥 Victor Osuagwu

27/06/2021

One correct group wey de do tins wey go make Cross River State Southern Senatorial District better don chok mouth tell Governor Ayade sey ...

25/03/2021

Telling the Nigerian story.

17/10/2020

Telling the Nigerian story.

03/09/2020

De Oga kpatakpata of Ben Akak Foundation, wey bi Oga Ben Akak don tok sey him choose to do business so dat him go fit help pipo wey no fit...

05/08/2020

THROWBACK PHOTO

From right: President Muhammadu Buhari pictured with former Senate President, Bukola Saraki and former Emir of Kano, Dr Sanusi Lamido during a prayer session...

Describe this picture in your words....

  wan increase Petrol price According to tori wey waka come reach us for our newstable, de pipol wey dem de call Petrole...
05/08/2020

wan increase Petrol price

According to tori wey waka come reach us for our newstable, de pipol wey dem de call Petroleum Products Marketing Company, PPMC don carry price of petrol for ex-depot go keep for up.

Ex-deport price na price wey pipol wey get deport dey sell petroleum products give those other pipol wey go retail am give common man. Naso dem come tok sey de new price ex-depot price na go come be N138.62 for one litter. Pipo wey sabi dis tori well well tok sey before before de difference between ex-depot price and pump price de always be N15.

For de paper wey de oga chairmo of PPMC wey de in charge of sales, Mohammed Bello, bin sign for Abuja, him tok sey de new price go start from 5th of August and e go also affect diesel and kerosene. De new ex-depot price for Diesel now na N165 while Kerosene go be N160.

Even though we de original pipol wey de fix petrol pump price wey be Petroleum Products Pricing Regulatory Agency, PPPRA, never chuck mouth for de matter, but pipo don dey tok sey as things be so now, petrol pump price of petrol fit reach N145 to N155 for one litre.

BREAKING:De oga kpatakpata of education for state wey  don tok sey school children go write WAEC exams from 4th of Augus...
06/07/2020

BREAKING:

De oga kpatakpata of education for state wey don tok sey school children go write WAEC exams from 4th of August to 5th of September 2020.

While those wey go write NABTEB and NECO exams to write am later when dem announce de date

De Minister of State for Education bin tok dis one during Briefing

President Buhari don swear-in 3 commissions and thier chairmen, this afternoon.Dem be:1. Chairman and commissioners of d...
02/07/2020

President Buhari don swear-in 3 commissions and thier chairmen, this afternoon.
Dem be:

1. Chairman and commissioners of de Federal Character Commission,

2. Commissioners wey dey chook eye for Revenue Mobilisation Allocation and Fiscal Commission

3. Federal Civil Service Commission.

The swearing-in bin happen today for Council Chambers, State House, Abuja.

09/05/2020

e get why

Abeg Ayade na farmer? See wetin him do for farm todayUna sabi sey de governor of Cross River state don de brag since 201...
08/05/2020

Abeg Ayade na farmer? See wetin him do for farm today

Una sabi sey de governor of Cross River state don de brag since 2015 how him go do farm, rice farm, beans farm, chicken farm and all de gbo-gbo-tigbo.

Naso last month im come pack pipo children sey him wan give dem work for farm wit 30k as deir salary. We come hear sey de farm na digital farm wey dem go use machine and tractors for de farm, in short de governor don send all the machines and tractors go for all de different farms we him get.

Onlty for us to come see as pipo children de use cutlass and marchet de clear swarm for Jonathan byepass near Industrial park.

Today we come see as Ayade dress like cowboy enter de place. Naso him media pipo begin de snap picture talk say him go farm.

My question be say, Ayade na farmer?

If true true him be farmer, him for sabi sey for naija farming work no de use Cowboy cloths. Na either you be digital or mechanize farmer wey de use tractor and machine or you be normal localize farmer wey de use hand work.

You no fit de use hand and cutlass de work for ya farm come de wear cow boy clothes go farm, na who you warn deceive?

18/04/2020

A controversial Pastor in Calabar, Cross River state, Val Aloysius has said that he'll bring Abba Kyari, President Buhari's Chief of Staff who died of Coronavirus back to life. He asked the family not to be in a hurry to bury him.

05/04/2020

Police wey dey for Eket Divisional headquarters don arrest plenti pastors wey fit reach 10 becos dem hold church service today for...

Coronavirus: about 250,000 pipo don well for de whole wold According to infomate wey we gada, about 250,000 wey bin sick...
05/04/2020

Coronavirus: about 250,000 pipo don well for de whole wold

According to infomate wey we gada, about 250,000 wey bin sick of coronavirus don well o.

Dey tori tok sey na 1,216,422 pipo don carri de sickness as for today while 252,478 pipol don well from de sickness and de sickness don kill 65,711 pipo for de whole world

Number of recovered coronavirus patients has reached 250,000 worldwide.

Na na na: Corono don enter Akwa IbomTori wey come meet us, tok sey dat sickness wey de ki pipo anyhow from China, wey de...
01/04/2020

Na na na: Corono don enter Akwa Ibom

Tori wey come meet us, tok sey dat sickness wey de ki pipo anyhow from China, wey dem dey call Coronavirus don enta Akwa Ibom State.

De tori tok sey na de pipo wey de control yama yama sickness for Naija, wey dem de call National Center for Disease Control, NCDC bin come tok sey dem don discover 5 pipo wey get de sickness for Akwa Ibom.

According to de center wey de control sickness for Naija, de total number of pipo now we don get de sickness don reach 179 for 12 states for Nigeria.

25/03/2020

Frank Okiye, Speaker Edo S tate House of Assembly According to test wey dem do for de oga kpatakpata of Edo State House of Assemb...

23/03/2020

Telling the Nigerian story.

Atiku pikin don carry CoronavirusBefore before Vice president of Nigeria and one time President candidate for de last el...
22/03/2020

Atiku pikin don carry Coronavirus

Before before Vice president of Nigeria and one time President candidate for de last election, Alhaji Atiku Abubakar don tok sey him pikin don get Coronavirus.

Atiku tok dis one for him official page last night. Him come open up tell de while world sey dem don carry him pikin go Gwagwalada Specialist Teaching Hospital for Abuja where dem wan go treat am.

Naso him come beg Nigerians make dem pray sey make him pikin well.

Abubakar also advise Nigerians to stay safe make dem no follow get de sickness

COVID-19: Make una no arrest pipo any how o! IG warn police officersThe Ogar kpatakpata for police work for Niaja, Ogar,...
22/03/2020

COVID-19: Make una no arrest pipo any how o! IG warn police officers

The Ogar kpatakpata for police work for Niaja, Ogar, Mohammed Adamu, don warn police officers for Naija sey make dem no arrest pipo any how and make dem no gree make pipo dey visit police stations anyhow.

Ogar IG come tok dis one as e take concern dis sickness wey dem de call Coronavirus. Him tok sey make dem take time well well before dem arrest or detain any body wey dem suspect to be criminal. Sey make dem reduce their arrest rate very much and if they must arrest or detain anybody make them screen de person well well before dem allow am enter police cell.

EFCC wan carry ma, OyoIta go Court on MondayDe pipo wey de catch person wey tiv money for office, EFCC wey be  Economic ...
22/03/2020

EFCC wan carry ma, OyoIta go Court on Monday

De pipo wey de catch person wey tiv money for office, EFCC wey be Economic and Financial Crimes Commission tok sey dem wan carri former head of service for Naija go court on Monday becos dem suspect sey she bin tiv small mini for office.

De pipo bin tok dis one today wey be Sunday 22nd March 2020 through their tok tok person, Mr. Tony Orilade. Dem tok sey 8 other persons go follow for de matta

Ogar Orilade tok sey de other 8 persons wey join de matta na: Frontline Ace Global Services Limited; Asanaya Projects Limited; Garba Umar and his companies: Slopes International Limited; Gooddeal Investments Limited; Ubong Okon Effiok and him company, U & U Global Services Limited and Prince Mega Logistics Limited.

Orilade add tok sey de nine suspects go de present for federal high court, Abuja.

3 pipol don receive beatings, becos dem tok sey Buhari try pass Jonathan 3 young men for Ibadan don see wenk as crowd of...
19/02/2020

3 pipol don receive beatings, becos dem tok sey Buhari try pass Jonathan

3 young men for Ibadan don see wenk as crowd of pipol gada dem wit beatings, becos dem tok sey dem happy for de way wey Buhari dey rule de economy, dem tok sey e better pass Jonathan.

Na so pipo wey dey for de place com gads dem for bodi o, wit heavy beatings becos de tori no sweet dem for bodi at all.

Na Justice Tanko go be Oga Kpatakpata wey go sidon for de case to look into the matta again as e take concern Bayelsa an...
17/02/2020

Na Justice Tanko go be Oga Kpatakpata wey go sidon for de case to look into the matta again as e take concern Bayelsa and Imo State judgement.

Remember sey Supreme Court bin don sack Oga David Lyon as Governor of Bayelsa state, and also Ihedioha as governor of Imo state. So after de court sack them, dey come go write give de court sey, they no satisfy with the judgement wey de court give.

As our constitution gree, na so the Supreme Court come take put people together wey dem call panel to look into de matta again for the second time.

De panel wey na oga kpatakpata for de Country Law pipo(Judiciary) d sidon as head go start their work tomorrow wey be Tuesday 18th February 2020.

Members of the panel na:

Chief Justice Ibrahim Tanko Muhammadu - Chairman

Justice Nwali Sylvester Ngwuta - Member

Justice Olukayode Ariwoola - Member

Justice Amiru Sanusi - Member

Justice Amina Adamu Augie - Member

Justice Uwani Musa Abba Aji -- Member

Justice Kudirat Kekere-Ekun - Member

Me, I be lawyer, you, Which school you go? Na de question wey Wike ask Oshiomhole be dat.Gocernor Nyesom Wike of Rivers ...
17/02/2020

Me, I be lawyer, you, Which school you go? Na de question wey Wike ask Oshiomhole be dat.

Gocernor Nyesom Wike of Rivers state wan cause confusion again o. See de kind hard question wey him come ask Adams Oshiomhole. Him tell Oshiomhole sey make him resign as National Chairman of APC because him bin no fit stop the swearing in of Sen. Douye of Bayelsa State.

Naso Weki come tok sey make shame catch Oshiomhole as Las las PDP don take over Bayelsa, even as APC bin fight to tiv de mandate of the people.

"how Oshiomhole go fit compare himself with me? I be lawyer wey dem train well well, I also get first degree for political Science, and I also pass Nigerian Law school with good result. Him Oshiomhole which University wey him go" ? Na wetin Wike tok be That.

Time don reach make you start to do work, Na so de new oga kpatakpata for YPP, C'River tell oga Ayade.The new Oga kpatak...
16/02/2020

Time don reach make you start to do work, Na so de new oga kpatakpata for YPP, C'River tell oga Ayade.

The new Oga kpatakpata for Young Progressives Party, for Cross River State, Ogar Anthony Bissong Attah bin don tell Ogar governor of Cross River State sey him Waka don tire pipol, make him stop to de Waka upandan de sign MoUs, time don reach make him take him seat for front carry Cross River tate jejely go reach where e supose reach.

Ogar Attah bin tok dis one wen him bin de discuss wit tori pipo for Calabar dey tell dem sey, him don take over de leadership of the party after d former Chairman, Mr. Castro Ezama bin come resign leave de party sey him dey expect appointment from Ogar Ayade so him no go fit be State government appointee come be anoda party Chairman again.

As de tori bin de go, na so Attah bin come tok sey, Ayade don sign plenty agreements with Oyinbo since him enter office but nobody don see de work wey de plenty, plenty agreement don do give de state.

Him come tok sey make Ayade, quick quick make sure sey all de street light de work, sey make water board begin dey supply water give pipo, make him return all de teachers wey him bin sack, then make him come pay minimum wage.

12/01/2020

De Obong of Calabar wey be His Eminence Edidem Ekpo Okon Abasi Otu V Treaty King, Natural Ruler, Grand Patriarch of the Efiks and ...

09/01/2020

Obong of Calabar don prepare to receive him friend, Oba of Benin come Calabar Get link Facebook Twitter Pinterest Email Other Apps January 08, 2020 According to de tori wey come for our tuk tuk table, His Eminence, Edidem Ekpo Okon Abasi Otu V, Natural Ruler, Treaty King of the Efik and the Obong of...

Address

Wuse
Abuja
900001

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when As e Happen 247 posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Videos

Shortcuts

  • Address
  • Telephone
  • Alerts
  • Videos
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share