Ghetto Pikin

Ghetto Pikin Pikin wey use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old:

15/10/2024

'We don almost finish to straight the bend-bend leg of una National grid'
- TCN

D presido of Cote d'Ivoire Alassane Ouattara don  ring bell call other  West African countries say; my pipu  for 2026, e...
14/10/2024

D presido of Cote d'Ivoire Alassane Ouattara don ring bell call other West African countries say; my pipu for 2026, e go too make sense, if we get away own money .

We fit even call am 'Eco'

Wetin you think?

'The only thing wen make us collect the 70k minimum wage, na make government for nor increase fuel price' NLC President
12/10/2024

'The only thing wen make us collect the 70k minimum wage, na make government for nor increase fuel price'

NLC President

🥰🥰🥰
11/10/2024

🥰🥰🥰

“Guy,no think am, you no reach to bring down army plane”~ Naija Army reply to Asari Dokubo for him viral video
10/10/2024

“Guy,no think am, you no reach to bring down army plane”

~ Naija Army reply to Asari Dokubo for him viral video

25 years after Dem act, “Issakaba”  dat Nollywood film wen make brain da year, we hear say e dey come back.I no say Gen ...
10/10/2024

25 years after Dem act, “Issakaba” dat Nollywood film wen make brain da year, we hear say e dey come back.

I no say Gen Z no go understand ☺️☺️

EWELEKE!Everywhere don burst as Ned Nwoko, Nwababy; Regina Daniel dey give us hot hot for her birthday .If she not give ...
10/10/2024

EWELEKE!

Everywhere don burst as Ned Nwoko, Nwababy; Regina Daniel dey give us hot hot for her birthday .

If she not give us, how we wan take collect na!?

“Return d fuel price for where you meet am sharpaly,  before we show you awa red eye”~ NLC dey tell Federal Government
10/10/2024

“Return d fuel price for where you meet am sharpaly, before we show you awa red eye”

~ NLC dey tell Federal Government

SAD NEWS.Former naija national team goalkeeper Peter Fregene dey life support for one hospital for Oghara, inside Delta ...
10/10/2024

SAD NEWS.

Former naija national team goalkeeper Peter Fregene dey life support for one hospital for Oghara, inside Delta State,

We hear say e dey fight kung fu to take recover him life back for dia and the way the story go, e mata critical gan.

EWELEKE!Nothing gbancern Lagos VIO and that thing wen court talk say VIO no get power to seize or stop  moto for road.~ ...
10/10/2024

EWELEKE!

Nothing gbancern Lagos VIO and that thing wen court talk say VIO no get power to seize or stop moto for road.

~ Lagos state government

EWELEKE!Naija Army don put one of dia oga,  Brigadier General M.A. Sadiq of 3 Brigade Kano State  inside back of counter...
10/10/2024

EWELEKE!

Naija Army don put one of dia oga, Brigadier General M.A. Sadiq of 3 Brigade Kano State inside back of counter on top say Dem say e kolobi the rice wen Dem give am for palliative, still come sell some army property like moto, generator and other mere meres join.

FOTO OF THE DAY:Una remember for 2012, wen some pipu go build roadblock for ojota say Dem no go gree until fuel go back ...
10/10/2024

FOTO OF THE DAY:

Una remember for 2012, wen some pipu go build roadblock for ojota say Dem no go gree until fuel go back #65 from #120?

EWELEKE!Lagos state government  don comot come beg all d Youth Dem say , ejoor, make una begin  to join awa army
10/10/2024

EWELEKE!
Lagos state government don comot come beg all d Youth Dem say , ejoor, make una begin to join awa army

EWELEKE!Federal government don draw ear give everybody, say abeg for dis fuel wen e put Money mata, make nobody call dia...
10/10/2024

EWELEKE!

Federal government don draw ear give everybody, say abeg for dis fuel wen e put Money mata, make nobody call dia name because Dia hand nor dey inside.

EWELEKE!Naija First Lady, Oluremi Tinubu don kneel down dey beg everybody say abeg make una dey put eye for ground, no l...
10/10/2024

EWELEKE!
Naija First Lady, Oluremi Tinubu don kneel down dey beg everybody say abeg make una dey put eye for ground, no loose guard!

Try to be your brother and sister keeper cos as e be, everywhere don red, and pipu dey pass through a lot

EWELEKE!Oya na, as una say fuel no gree una buy again,  federal road safety commission (FRSC) don advise everybody to go...
10/10/2024

EWELEKE!

Oya na, as una say fuel no gree una buy again, federal road safety commission (FRSC) don advise everybody to go buy Urges Bicycles f

Wetin una think?

Oya Loud am🎤
01/10/2024

Oya Loud am🎤

EWELEKE!Heeeyssss!!Yes you!I just want let you know say If you nor chop cabin biscuits wen dis two bros dey the front pa...
30/09/2024

EWELEKE!

Heeeyssss!!

Yes you!

I just want let you know say If you nor chop cabin biscuits wen dis two bros dey the front packet, ayam nur your mate.

Don't play!😎

EWELEKE!How una dey na?I no say e don tey small wen I show face here but no worry , mi don land back like season feem!😎O...
30/09/2024

EWELEKE!

How una dey na?

I no say e don tey small wen I show face here but no worry , mi don land back like season feem!😎

Oya na, as we dey talk feem, ma rush ask... You don watch dis Lisabi feem?

HOW You SEE AM?

Drop ya mind👇👇

24/09/2024

The Hidden Life of a Pastor: Secrets That Shocked the Community

My pipu, I just wan sonsh una, make  una know say, una girl sabi write and voice pidgin English, Ibibio and Efik languag...
17/09/2024

My pipu,

I just wan sonsh una, make una know say, una girl sabi write and voice pidgin English, Ibibio and Efik language.

Whether you want am for book, exam paper, drama... Anyhow babe mount!

Make you sharpaly send message to 0813-589-2362

Abeg epp me move dis ministry to the permanent site, share am to una friends.🙏🙏

Diswan wen my body dey do me like say ma enter army barracks dis morning, slap soldier, come shout 'I am a chosen, who a...
16/09/2024

Diswan wen my body dey do me like say ma enter army barracks dis morning, slap soldier, come shout 'I am a chosen, who are you?!

Una sure say I well so?

!

15/09/2024

Isbae_u Don collect for Frank Edoho hand.

Diswan na technical knockout.
You put body, you collect!

EWELEKE!🤣🤣🤣

Send a message to 0813-589-2362 for your Professional Voiceover jobs in English, Pidgin English and Ibibio.
14/09/2024

Send a message to 0813-589-2362 for your Professional Voiceover jobs in English, Pidgin English and Ibibio.

14/09/2024

EWELEKE!
Guys!
Na true say wen Satan see say heartbreak no dey pain una again ,e bring betting?🤔🤔

Address


Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Ghetto Pikin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Ghetto Pikin:

Videos

Shortcuts

  • Address
  • Alerts
  • Contact The Business
  • Videos
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share