23/06/2023
My people no be only for Naija League dem dey owe players salary or even no gree pay transfer fee as we don dey hear now say one player wey dey play for Boavista inside Portugal league, Reggie Cannon don abandon the club and dem plenty wahala after the club no gree pay am salary since dis year. Not only the salary sef, even him transfer fee of 2.6 million pounds, the club never pay 1 Naira inside.
According to the tory, na for 2020 naim Boavista waka from Portugal enter America for FC Dallas say dem wan sign the player. After the clubs agree bride price of 2.6 million, oya make Boavista pay na, dem say make Dallas wait make dem go sample dem new wife fes. Na so the bobo join Boavista like say na free olosho transfer. One year later naim Dallas go meet Boavista again say dem don dey sample the wife for more than 1 year now, make dem try pay even if na half of the bride price make dem know say dem don do small sontin for the bobo head but the club no gree pay even one kobo. Na so Boavista continue dey sample dis bobo for 3 straight years without doing anything for him head. Na diswan make Dallas provoke carry dem go court wey court say Boavista must pay dat bride price, even give dem deadline, but those Boavista people get very strong coconut head and dem still no pay the money after deadline pass. Then to make matters worse, dem con dey owe the player salary join. Now to buy food feed him family or even send back home to take care of him mama and papa, Reggie no fit afford am inside dis Tinubu economy. Na diswan make Reggie provoke say mbanunu, even prodigal son no suffer reach like dis so I will return back to my fathers house even if na garri i dey drink, make I sha use da wan take dey breet from there make I rearrange my life.
My people how una see dis kind Boavistan witchcraft dis early morning so?