Life Gist

Life Gist Life story gist and fiction gist

25/12/2024
24/12/2024

Na God dey give pickin treasure your own

16/12/2024

Abeg no remove that pickin. πŸ™‡β€β™€οΈ
πŸ«„Any time wey girl wey never marry carry belle. Them go call am 'unwanted pregnancy' and the next thing na to flush the pickin commot like s**t for toilet.

πŸ«ƒThe one wey bad pass be sey even married woman wey dey im husband house go follow do am. Call am mistake.

πŸ™†β€β™€οΈAbeg o na who tell una sey the pickin be unwanted or mistake?πŸ€¦β€β™€οΈ

πŸ™…β€β™‚οΈPeople dey use fine fine excuse take dey commit murder for broad daylight πŸ™„

🀱Abeg any time you preg just born the pickin abeg. Many people dey find pickin... You... you dey flush your own commot.

πŸ™…β€β™€οΈHaba eno good nah... Eno good make you let the pickin live nah.

πŸ€·β€β™€οΈIf you no want pickin den no sleep with man.
Na beg I dey beg you. No do am again

πŸ™‹β€β™‚οΈTry keep the pickin e fit be your savior tomorrow.
πŸ€¦β€β™€οΈNo matter how difficult keep the pickin or handover to woman wey dey find pickin to born

πŸ«„Make you try love that pickin for your womb abeg

LifeGist

Wetin person eat fit kill am and the way person eat fit cus wahala for body.If you no eat for 2days. Suddenly you come s...
15/12/2024

Wetin person eat fit kill am and the way person eat fit cus wahala for body.

If you no eat for 2days. Suddenly you come see food. Abeg no try eat two days food for one time o

This fit cus big problem for you.
Na im make e good make person get self control for everything.
I mean everything

23/09/2024

Shame wey pass shame

We been meet one guy many years ago and the guy na driver for one private school.
Wey we come see sey the guy no sabi read and write, we come advice am make im take private lesson for one evening adult school. At least so that e go fit they read signpost for road.
The guy no gree o.πŸ™„
Make una hear Tori o
The guy sey im dey shame because im age don pass age wey dey go school.
Wetin dey to shame for there sey person dey go school.
Which shame pass now sey you no sabi read and write or sey you dey go school?

Abeg anywhere wey una see am, make una advice am because me I don tire for am.
I no know why person go dey shame for wetin wan add value for im life.
Make I come.
πŸƒπŸƒπŸƒπŸƒπŸƒπŸƒπŸƒ

22/09/2024

Today na Sunday some go church.some no go. Where e bad be sey some go church no be to go learn add for their life

Some go to see their bestie
Some wan new catch
Some go analyse pastor English
Some go make trouble
And many other reason
You wey go church today abeg wetin carry you go?
Nah wetin you learn add for the one wey you don learn before?
Make you answer me o.
Make I know how to advise you abeg.

21/09/2024

Ekemini my new follower welcome o.
I happy as I see you for here o
How yondah dey nah
Welcome on board

21/09/2024

My new follower Mary welcome o
Na bloomGirl gist page be this.
This page go help you well well.
Thank you for following
Good bless you for me

21/09/2024

My first follower Antia for this page, I celebrate you well well.
I no go fall your hand.
I go post plenty gist for here
Thank you oooo
God bless you for me

21/09/2024

Some of us no dey like fast wen we get wahala..
Fasting no dey kill anybody o
I never hear sey fasting kill anybody since wey my mama born me.
Abeg my bros, abeg my sis add fasting e no go kill you.
You hear me so.
Na me bloom.girl

20/09/2024

My people my gist go soon drop o. Make una dey patient with me.
Una thank you o

19/09/2024

Never learn

As she comot for house o this early morning. She just hear voice wey tell her say make she carry her umbrella. She take style look up, correct sun dey shine. Infact ehnn no sign of cloud dey sky.
She come wonder why she go carry umbrella they go where she dey go... Added burden abi?
She comot go her waka..do everything wey she wan do. Enter bus dey return. As she enter her area, omoh flood no be here o
The kind 🌞 sun wey.shine where she from dey come they equal to the kind flood wey she dey see
Funny thing be sey where bus wan drop her no place to even stand or hid from the rain.
She come remember her umbrella for house.
Nah so water soak her like sey dem put her inside drum comot.
Abeg anytime God signal you no waste time to obey nah for your good.
Now wey she wet for the long distance to reach house nah God wet?
And the bad part be sey e don happen before.
Make you no dey like her o
Make I hear una comment 😊

Address

Abak Road
Uyo Obio

Opening Hours

Wednesday 09:00 - 22:00
Friday 05:00 - 22:00

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Life Gist posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share