Kontri News

Kontri News We sama you with papapa press review every hour, everyday

23/10/2023

Di health condition of Nollywood actor, Mr Ibu don become very critical matter because of decay for some parts of hin body.

Controversial commentator, VeryDarkMan give di update from hin recent visit to di actor hospital as hin dey request for funds for hin healthcare.

Communities for new Oko-Oba and Abule Egba for Lagos State dey beg Governor Babajide Sanwo-Olu make hin go fast repair d...
23/10/2023

Communities for new Oko-Oba and Abule Egba for Lagos State dey beg Governor Babajide Sanwo-Olu make hin go fast repair di roads wey spoil during di construction of Abule Egba Flyover by di past administration of Akinwumi Ambode.

Inside di letter wey communities dey beg Sanwo-Olu, dem yarn say nobody don come assure dem say dem go do something about di road.

23/10/2023

Yesterday, di PDP yarn say dem get confident say dia appeal go succeed for di Supreme Court.
Inside statement by di National Publicity Secretary, Debo Ologunagba, di PDP yarn say dia confidence dey on di provisions of di Constitution and relevant sections of di Electoral Act 2022 (As amended).

Mr Bayo Onanugta, Special Adviser on Information and Strategy to President Tinubu, don accuse di followers of Atiku and Obi say dem dey try rush di Washington, D.C. court make dem change di order wey dem bin give FBI to release documents on President Tinubu’s forfeiture case of 1993.

Vice Chancellor, University of Abuja, UniAbuja Prof. Abdul-Rasheed Na’allah reveal say students wey plan to study for di...
05/10/2023

Vice Chancellor, University of Abuja, UniAbuja Prof. Abdul-Rasheed Na’allah reveal say students wey plan to study for di university must undertake and present drug test before admission.

Na’allah, wey tok dis matter for di 27th Pre- Convocation briefing for Abuja on Wednesday, yarn say di institution dey work with NDLEA to help students wey dey involved in drug abuse and to rehabilitate dem.

Vice Chancellor UniAbuja Prof. Abdul-Rasheed Na’allah tok say students wey wan study for di university must present drug test before admission

One Sabo, Yaba, Chief Magistrate Court, yesterday, remand Abdulazeez Fashola, also known as Naira Marley (32), and three...
05/10/2023

One Sabo, Yaba, Chief Magistrate Court, yesterday, remand Abdulazeez Fashola, also known as Naira Marley (32), and three others for di claim of conspiracy in di murder of singer Oladimeji Aloba, wey pipo sabi as Mohbad.

Di other pipo wey dem remand na Ogedengbe Fisayo (37), Ayobami Sadiq (27), and Samson Eletu, wey pipo sabi as Sam Larry (45).

One Sabo, Yaba, Chief Magistrate Court, remand Naira Marley (32), and three others for di claim of conspiracy in di murder of Mohbad.

05/10/2023

Di Presidency insist say di certificate wey President Bola Tinubu present to di Independent National Electoral Commission, INEC, no be fake.

Di leadership of di organised labour go meet with dia organs today to discuss di N35,000 provisional wage award wey fede...
02/10/2023

Di leadership of di organised labour go meet with dia organs today to discuss di N35,000 provisional wage award wey federal government approve yesterday for all treasury-paid federal workers for six months.

Di leadership of di organised labour go meet with dia organs today to discuss di N35,000 provisional wage award federal government approve.

02/10/2023

Bovi Ugboma, wey be well-known stand-up comedian and actor, don accuse Basketmouth say na wicked person di guy be.

Davido, wey be well-known Nigerian Afrobeat musician, don publicly express hin love for Big Brother Naija All-Stars winn...
02/10/2023

Davido, wey be well-known Nigerian Afrobeat musician, don publicly express hin love for Big Brother Naija All-Stars winner Ilebaye Odiniya inspiring story.

Davido, wey be well-known Nigerian Afrobeat musician, publicly express hin love for Big Brother Naija All-Stars winner Ilebaye Odiniya.

Nollywood actress Tonto Dikeh don react to di arrival of di assistant of Naira Marley, Sam Larry for Nigeria after Mohba...
29/09/2023

Nollywood actress Tonto Dikeh don react to di arrival of di assistant of Naira Marley, Sam Larry for Nigeria after Mohbad death.

Tonto Dikeh, enter her page claim say di popular socialite Samson Balogun Olamilekan Eletu, aka Sam Larry, bin try to sneak enter di kontri but police arrest am for di Lagos’ Murtala Muhammed International Airport.

Nollywood actress Tonto Dikeh don react to di arrival of di assistant of Naira Marley, Sam Larry for Nigeria after Mohbad death.

Di World Health Organisation WHO don release 16 million dollars from di WHO Contingency Fund for Emergencies to tackle c...
29/09/2023

Di World Health Organisation WHO don release 16 million dollars from di WHO Contingency Fund for Emergencies to tackle cholera.

28/09/2023

Di Labour Party don advise dia supporters across di kontri say make dem to stock dia house with necessary items ahead of di indefinite strike

National President of di Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers, NALPGAM, Mr. Abideen Olatunbosun, ye...
28/09/2023

National President of di Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers, NALPGAM, Mr. Abideen Olatunbosun, yesterday, express hin concern over di rising price of gas. Hin add say if FG no address di matter, gas fit become commodity wey only pipo wey get plenty money go fit buy.

Olatunbosun, yesterday, express hin concern over di rising price of gas. Hin add say if FG no address di matter, e go become big problem.

According to  Kemi Olunloyo wey dey threaten Mohbad wife, she tok say she don already get di report of di DNA test. And ...
27/09/2023

According to Kemi Olunloyo wey dey threaten Mohbad wife, she tok say she don already get di report of di DNA test. And na why she want make Wunmi come out reveal di man wey father her pikin.

Controversial investigative journalist Kemi Olunloyo don threaten di wife of Mohbad, Wunmi over di paternity of her pikin.

Di Nigerian Air Force fighter, NAF jets under di air component of Operation Udo Ka II, on Tuesday, destroy di armouries ...
27/09/2023

Di Nigerian Air Force fighter, NAF jets under di air component of Operation Udo Ka II, on Tuesday, destroy di armouries and hideouts of IPOB, Indigenous People of Biafra combatants for Anambra and Imo states.

NAF jets under di air component of Operation Udo Ka II, on Tuesday, destroy di hideouts of IPOB, for Anambra and Imo states

LAGOS— Despite di ultimatum wey Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State give to order sanity along di Oshodi-Apapa Ex...
27/09/2023

LAGOS— Despite di ultimatum wey Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State give to order sanity along di Oshodi-Apapa Expressway, truck drivers and touts, yesterday, dare di governor Sanwo-Olu say make hin try evict dem.

Upon di ultimatum by Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State, truck drivers yesterday dare di Sanwo-Olu say make hin try evict dem.

27/09/2023

Di Peoples Democratic Party PDP, don call for prayers for Nigeria as dem join di Muslim Umma to celebrate dis year Eid-el Maulud.

Notable actress, Regina Daniels don explain di reason why she marry her billionaire husband, Senator Ned Nwoko, as hin s...
25/09/2023

Notable actress, Regina Daniels don explain di reason why she marry her billionaire husband, Senator Ned Nwoko, as hin sixth wife.

She use popular soundtrack explain say bullion van no dey physically attractive.

However, if person enter inside, dem go see di real beauty of am – dis na reference of how wealthy her billionaire husband be.

Regina Daniels don explain di reason why she marry her billionaire husband, Senator Ned Nwoko, as hin sixth wife.

Dangote Group don deny claims about di price slash of Cement to N2,700 per 50-kilogramme bag from N5,500.Anthony Chiejin...
25/09/2023

Dangote Group don deny claims about di price slash of Cement to N2,700 per 50-kilogramme bag from N5,500.

Anthony Chiejine, Spokesperson for Dangote Group, reveal dis tori Monday.

Chiejine describe di claim as fake news.

Dangote Group don deny claims about di price slash of Cement to N2,700 per 50-kilogramme bag from N5,500. Dem describe di claim as fake news.

One 80-year-old man, Malam Rabiu, wey pipo sabi as Na Allah Siraka don kpai inside well wey dey Sabon Sara, Gidan Aminu ...
25/09/2023

One 80-year-old man, Malam Rabiu, wey pipo sabi as Na Allah Siraka don kpai inside well wey dey Sabon Sara, Gidan Aminu Ado, for Gwale Local Government Area(LGA) of Kano State.

Na inside statement from newsmen by di Public Relations Officer of Kano State Fire Service, Alhaji Saminu Abdullahi on Sunday na hin dem confirm di tori for Kano.

One 80-year-old man, Malam Rabiu, wey pipo sabi as Na Allah Siraka don kpai inside well wey dey Sabon Sara, Gidan Aminu Ado, for Kano State.

E don pass two weeks now wey Central Bank of Nigeria, CBN promise say dem go clear over $10bn foreign exchange debts wey...
25/09/2023

E don pass two weeks now wey Central Bank of Nigeria, CBN promise say dem go clear over $10bn foreign exchange debts wey dem owe Deposit Money Bank, di apex bank still neva do anything according to findings.

CBN promise say dem go clear over $10bn foreign exchange debts wey dem owe Deposit Money Bank, but dem neva do anything about am.

Unknown number of students for di Federal University of Gusau don enter di hand of kidnappers dis morning, Friday, 22nd ...
22/09/2023

Unknown number of students for di Federal University of Gusau don enter di hand of kidnappers dis morning, Friday, 22nd September 2023.

Also, one resident of Sabon-Gida, wey dey identified as Nazeer Sabon-Gida, tell newsmen say di gunmen raid di community around 3 a.m. and na so dem start to dey shoot anyhow.

Unknown number of students for di Federal University of Gusau don enter di hand of kidnappers dis morning, Friday, 22nd September 2023.

One well-known artist,  wey pipo sabi as Kizz Daniel, don come out claim say na bullying wey hin experience when hin sma...
22/09/2023

One well-known artist, wey pipo sabi as Kizz Daniel, don come out claim say na bullying wey hin experience when hin small na im make to socialise with pipo dey hard for am.

Hin claim say when hin still small, di other pikin for hin yard dey always bully am and dem dey take am do yeye because hin bin dey overweight.

Kizz Daniel, don come out claim say na bullying wey hin experience when hin small na im make to socialise with pipo dey hard for am.

Self-proclaimed international journalist, Kemi Olunloyo, don make hin claim say CEO of Marlin Music, Naira Marley, dey o...
22/09/2023

Self-proclaimed international journalist, Kemi Olunloyo, don make hin claim say CEO of Marlin Music, Naira Marley, dey owe di late singer, Mohbad, approximately ₦300 million.

Also, she claim say di late Nigerian singer dey worth around $690k.

Kemi Olunloyo, don make hin claim say CEO of Marlin Music, Naira Marley, dey owe di late singer, Mohbad, approximately ₦300 million.

Shey you hear say di New Nigeria People Party, NNPP dey blame former presidential candidate of di party, Rabiu Kwankwaso...
22/09/2023

Shey you hear say di New Nigeria People Party, NNPP dey blame former presidential candidate of di party, Rabiu Kwankwaso say na im dey responsible for di loss of Kano governor, Yusuf Abba for di State Governorship Election Petitions Tribunal.

Di party strong mouth tok say Kwankwaso sell NNPP to di ruling All Progressives Congress so dat im go fit negotiate for ministerial position for di President Bola Tinubu-led government.

NNPP dey blame former presidential candidate of di party, Rabiu Kwankwaso say na im dey responsible for di loss of Kano governor

Jimmy Odukoya wey be di first son of di popular late Pastor Taiwo Odukoya of Fountain of Life Church for Lagos State don...
20/09/2023

Jimmy Odukoya wey be di first son of di popular late Pastor Taiwo Odukoya of Fountain of Life Church for Lagos State don tok more about im journey to succeeding im father as lead pastor of di church.

Following di death and burial of Pastor Taiwo Odukoya for September, di Board of Trustees announce Jimmy Odukoya wey be im son as di new lead pastor of di church.

National grid don collapse again, just five days after dem restore am following similar incident wey lead to a total bla...
20/09/2023

National grid don collapse again, just five days after dem restore am following similar incident wey lead to a total blackout across di kontri.

National grid collapse again, just five days after dem restore am following similar incident wey lead to a total blackout across di kontri.

Di presidential candidate of Labour Party (LP) for di last election, Peter Obi, don file appeal on 51 grounds for Suprem...
20/09/2023

Di presidential candidate of Labour Party (LP) for di last election, Peter Obi, don file appeal on 51 grounds for Supreme Court.

Former Anambra State governor tok say hin no agree with di ruling of Presidential Election Petition Tribunal, wey dismiss hin case.

Di presidential candidate of Labour Party (LP) for di last election, Peter Obi, don file appeal on 51 grounds for Supreme Court.

Nollywood actress Regina Daniels wey also be di wife of Nigerian ogbonge businessman and politician, Ned Nwoko say polit...
18/09/2023

Nollywood actress Regina Daniels wey also be di wife of Nigerian ogbonge businessman and politician, Ned Nwoko say politics for Nigeria no easy at all.

Di 22 year old na di Social Secretary of di Senators’ wives association for Nigeria, she yarn say even though e be like say she don chook one leg for politics, she no wan do am full-time, at least for now

Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu give assurance say im go lead di investigation into di death of Nigerian musici...
18/09/2023

Govnor of Lagos state Babajide Sanwo-Olu give assurance say im go lead di investigation into di death of Nigerian musician in all ways required, to guarantee proper and diligent investigation.

Gas retailers don warn say di price of 12.5kg cooking gas fit hit N18000 by December if di Federal Government no limit d...
18/09/2023

Gas retailers don warn say di price of 12.5kg cooking gas fit hit N18000 by December if di Federal Government no limit di activities of di terminal owners.

Gas retailers warn say di price of 12.5kg cooking gas fit hit N18000 by December if di FG no limit di activities of the terminal owners.

Shurmda tok say Mohbad spirit no let am rest as hin know say na only him fit calm hin spirit down, by making sure say di...
18/09/2023

Shurmda tok say Mohbad spirit no let am rest as hin know say na only him fit calm hin spirit down, by making sure say di pipo wey make am live in fear no get rest too.

“And he don start. Yes, I mean wahaLa just wan start like this. I NO GO GREE.

Popular singer Bella Shmurda don vow to get justice for hin late friend, MohBad. Hin tok say Mohbad spirit no let am rest

Electric shock one yet-to-be-identified man to death wey dem suspect to be thief for di Nnamdi Azikiwe University for Aw...
13/09/2023

Electric shock one yet-to-be-identified man to death wey dem suspect to be thief for di Nnamdi Azikiwe University for Awka, Anambra State, UNIZIK.

Electric shock one man to death wey dem suspect to be thief for di Nnamdi Azikiwe University for Awka, Anambra State, UNIZIK.

One economist, Derego Williams, yarn say di energy sector go still remain Nigeria biggest challenge.Williams reveal dis ...
13/09/2023

One economist, Derego Williams, yarn say di energy sector go still remain Nigeria biggest challenge.

Williams reveal dis tori on Wednesday during Channels Television interview.

Hin yarn say lack of adequate power supply, increased fuel and diesel costs na di biggest obstacles to di kontri manufacturing sector.

One economist, Derego Williams, yarn say di energy sector go still remain Nigeria biggest challenge. Hin reveal di tori for interview

Nigeria Super Falcons forward Desire Ugochi Oparanozie don announce her retirement from football for both kontri and clu...
13/09/2023

Nigeria Super Falcons forward Desire Ugochi Oparanozie don announce her retirement from football for both kontri and club at di age of 29.

Vice president Kashim Shettima on Wednesday comot for Nigeria to represent President Bola Tinubu for di G77+China Leader...
13/09/2023

Vice president Kashim Shettima on Wednesday comot for Nigeria to represent President Bola Tinubu for di G77+China Leaders’ Summit for Havana, Cuba, wey go hold from Sept. 15 to 17.

Vice president Kashim Shettima on Wednesday comot for Nigeria to represent PresidentTinubu for di G77+China Leaders’ Summit for Havana, Cuba.

Di President of di Senate,  Senator  Godswill Akpabio,  don hail  President Bola Tinubu for wetin hin call,  hin creativ...
13/09/2023

Di President of di Senate, Senator Godswill Akpabio, don hail President Bola Tinubu for wetin hin call, hin creativity and proactiveness to resolve di visa crisis with di United Arab Emirate.

Di President of di Senate, Senator Godswill Akpabio, hail President Bola Tinubu as hin resolve di visa crisis with di United Arab Emirate.

Di song “Calm Down” by well-known artists Rema and Selena Gomez don win di Best Afrobeats category for di 2023 MTV Video...
13/09/2023

Di song “Calm Down” by well-known artists Rema and Selena Gomez don win di Best Afrobeats category for di 2023 MTV Video Music Awards (VMAs).

Nigerian singer, Ilerioluwa Oladimeji Aloba, wey pipo sabi as Mohbad, don kpa at age 27.According to entertainment journ...
13/09/2023

Nigerian singer, Ilerioluwa Oladimeji Aloba, wey pipo sabi as Mohbad, don kpa at age 27.

According to entertainment journalist Ovie, di 27-year-old Nigerian rapper, singer, and songwriter kpai on Tuesday, September 12.

Nigerian singer, Ilerioluwa Oladimeji Aloba, wey pipo sabi as Mohbad, don kpa at age 27. Nobody sabi wetin cause hin untimely death.

Veteran Nollywood actor Richard Mofe Damijo, better known as RMD, don tok say to maintain faithfulness for marriage dey ...
13/09/2023

Veteran Nollywood actor Richard Mofe Damijo, better known as RMD, don tok say to maintain faithfulness for marriage dey very hard.

Address


Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Kontri News posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

  • Address
  • Telephone
  • Alerts
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share