TrippleDjoffical

  • Home
  • TrippleDjoffical

TrippleDjoffical Storyteller|Mindset|Motivation
instagram.com/trippled_j
tiktok.com/?lang=en

25/03/2024

I don come again,

shey you know say some things dey happen for a reason?

I dey talk about four things wey dey happen for a reason.
watch am make you sef reason am.

https://youtu.be/NRW44cawN6I

18/03/2024

howfa, I don come with another one again o...
Make sure say u apply weitin you learn from this video o.

No go dull yourself to go dey watch am like that, because you feel say na cartoon.

apply the knowledge wey dey their oo.

https://youtu.be/b1DW6_BcV1I

15/03/2024

Howfa,
How una dey?

Hope say everywhere goood.
I don come again o.

Normally i go advice you to watch this video.
E be like time don dey reach make i dey add small small things and things for u...

make u join my community, make we grow together.

https://youtu.be/60mtbyGXeE8

11/03/2024

howfa,

How you dey.
hope everywhere good?

I don come again, with Ogbonge yans wey go help your life.

I no dey whine you.
"Eight things you need start dey do for 2024"

make you watch the video and apply weitin you learn o.

https://youtu.be/4xq7QkH7itA

07/03/2024

howfa, how u dey na. Hope say everywhere good. I don come with another Ogbonge yans with Ogbonge men. Make sure say you listen and apply weitin you hear...



https://youtu.be/4X5vUNo-Hog

04/03/2024

howfa,

how you dey.
I don come with another ogbonge yans.

This episode na about "Eight Things Wey Successful People Dey Do"

If you wan dey successful, make sure you watch this video.
Make sure say you apply weitin you hear o.

https://youtu.be/MwG6VJVuOx8

29/02/2024

5 dangerous women to avoid.
make una take note on the dangerous women to avoid,
so you no go fall inside trap .

woman way surround her self with plenty men they call them friends na better cheat be that.
woman way love you for money and no dey give yopu any value na financial parasite and vampire be that. make you run

follow the channel so you go dey get better insight like this, for your daily ginger.

https://youtu.be/Lj2O9bnYZ24?si=5Mx-3Udc1EMD94tX

26/02/2024

howfa,
how you dey?

Na me be TrippleDjoffical wey dey drop better yans with This Na Life.

This episode dey talk about 5 rules of the day.
Make sure you watch and apply what you learn o.

No go just dey watch dey catch cruise.

26/02/2024

Howfa,
how you dey.

Na me be TrippleDJ wey dey give ogbonge yans wey go help you dey motivated for this our obodo Naija.

I wan make you win, that's why i dey drop better inspiration wey go help you win. As you dey hear am, make you dey apply am o.

make sure say you follow me TrippleDjoffical to continue dey hear word way go help you win for life.

21/02/2024

https://youtu.be/JOFmMs6MCzM?si=EWzzF3x9qPNwe1WH
welcome na trippledj with this na life
Important guide of life
1: No reason to tell anyone weytin you dey do until is over. this fact dey lead to failure
2:No forget two times of people (i)people who dey with you because dey get interest. (ii)people who dey for difficult times
3: No depend on anybody so you go fit win
4: Reason options way you dey fear wella, because na weytin go make you grow
5: Respect people who hate you because na them accept say you better pass them
6: Always compare yourself with who you be a day before

16/02/2024

Welcome, na TrippleDj with another episode of This na Life.
five small stories wey get big meaning.

small things na him dey make big difference sometimes.
so make you learn from this little things and apply them for life to get big results.

make sure you follow this page to get more stories wey go change your life.

https://youtu.be/L0icx9uUF90

22/01/2024

https://youtu.be/XzLHD-CFiaw?si=HYsJUwvwVV6kGG7Q
8 facts you go need hear once for your life( safe this video to dey check your life)
welcome na trippledj with correct yarns with this na life.
1: people no dey against you but dey from themselves
2: You go learn more from failure than success, no let am stop fail your bill character
3: Climb mountains so you fit see the world ,no be the world to see you
4:Go where them go celebrate you ,no be where them go tolerate you
5: The person you go spend plenty time with na yourself, so better make yourself interesting fast
6: If you accept your limitation, you go move beyond
7: Anyone you meet they afraid of something, love something and don lost something
8: Comfort na the main enemy of achievement

12/01/2024

7 lessons people late for life(hold on for no 5)
welcome na trippledj with facts i don come to talk about with this na life.
1: Your obstacles na always yourself
2: When you invest in yourself e no fit disappoint you
3:When you dey calm na you strong pass
4: No help anyone way no want you to help
5: To dey alone normally better pass to dey with plenty wrong people
6: To dey forgive people in silent and no reason them again na better selfcare be that
7:To dey stay low key and not to share everything na form of selfcare.
https://youtu.be/9CxGw8BN-B8?si=ewL9hGbAXkoy740p

05/01/2024

https://youtu.be/nAAAmImrTKU?si=uz2Yvkn6eBpqLtyQ
8 inspiration to listen every morning (no 7 make sense )
welcome na TrippleDj i don come with this na life.
Back to the inspirations.
1: I dey ready
2: nothing fit stop me
3:I no go dey defeated
4:I be champion
5:I get clear goals
6:I get better purpose for life
7: I get clear mission
8: I over believe my self

5:

31/12/2023

https://youtu.be/k1r0rYdikfs?si=BTCHuFooIzoZj48L
welcome na trippledj with this na life.
congratulation to all of una wey dey with us here. Dey listen, like, share, comment and follow.
All of una don make am to 2024. weytin una desire go surely happen.

I say big thank you guys, for una unwavering love and support towards this channel for all social media platform. we no take una love for granted.
Happy sweet wonderful new year guys. Trippledj says big thank you. love you all.

25/12/2023

https://youtu.be/okTW9PBV1ug
merry Christmas

welcome, na trippleDj with this na life. December 2023 don almost finish. what if na to believe and everything wey you dey
hope for go come through.

I go like talk say your past thank you for the blessings and your future i am ready.
compliment of the season guys.

19/12/2023

welcome, this na trippleDj i don come i done come with words with this na life.

4 secrets of happiness(the last one na the real deal)

1;Happiness na choice not a result
2;No person go ever make you happy except you decide
3;Your happiness no go come to you, e go only come from you
4;Happiness na your decision. motivation

15/12/2023

https://youtu.be/M_sqnrfYq28?si=Tn9blfkBBOD1cS_
welcome, na trippledj with real fact with this na life.
4 tips to set boundaries with people

i want tell una about one of my domestic staff for house bher name is happiness. she be better staff, way don stay long with me for many years,she don turn my favourite. we all love her well well but she don loose her boundaries. she dey hold phone when on duty,e dey distract her and make her absent minded. she no dey really attend to the kids when she suppose to, because na the job she dey to do for house.

because of the love i get for her, i just dey complain of her style of work all the time , and she no take am serious. she dey leave most of her work for the next staff to carry on, which e no suppose be that way. so one day i don really dey tired with nher pattern, walked straight to her, look her in her eyes, make my point clear, say her pattern of work no good for me4 and my family.if she continues like this i go fire her. she sharp look me back, she know say i dey serious and she changed and begin do her duties.

back to the 4 tips to set boundaries.
1:show people how to dey treat you instead of you to dry complain
2: use of word,dey straight to express your concern
3: make you create positive atmosphere, start with better greetings
4: make you maintain better tone so your message go dey clear

if you love this video comment , subscribe , share to my channel and leave us a follow.

11/12/2023

welcome, Na me be TrippleDj.

Na me dey host This Na Life Series.
This Na Life Series go help you dey motivated. You know how things dey happen for the world this days.
This channel go help you improve your daily mindset. You go sure dey okay.
I be better Storyteller. If you dey listen, you go fit understand people well and get better relationship.

My own journey bin no easy, me sef my mindset bin no dey right. My relationship with some people also no dey okay. But i come learn some new things wey help me build positive mindset.

My relationship with people come dey well, I come realise say, no be always about them. Na the way i bin dey see things.

Motivation, Inspiration, Mindset and Storytelling.

If you are serious about changing your life, follow this page.

https://youtu.be/-ZFRGP7brhQ?si=IKU-n-1irZy20vhs

06/12/2023

Shout out to my newest followers! Excited to have you onboard!

Ebuka Francis, Naomi Ike, Elijah Omoifo, A MA KA, Aluko Olaniran Abiodun, Nwaka Oral, Muftiyat Sharafadeen, Taiye Ampitan, Abigail Ishaku, Joshua Matthews, Favour Isaac, Divine Emma, Theo Philus, Abi Gail, Mímí Dô, Na Zeer, Eric Og, Gimbiya Munat, Toch Ukwu, Dä Mï, Tim Best, Deborah Ekpeakhena, Bight Joy, Sikirullahi Abdulrasheed

29/11/2023

make sure you ask your mother this 7 things.

1. weitin be your happy memories with us?
2. weitin you wish for your children?
3. your first experience with motherhood, how e be for you?
4. weitin be the best thing i don ever do?
5. any family secret you want to share?
6. weitin be the best and the worst part as you dey old?
7. weitin be the one thing you want me to remember when you are no more?

https://youtu.be/HvOFbFBO2kQ

23/11/2023

Welcome, na TrippleDJ with another deep talk with this na Life.
E get this correct story i want una listen to.

E get one small town, dey live one fine girl called Soso, she young, smart, dey independent.
But one thing dey vex her say she dey single. no relationship with any man.

Soso wake up with big dream for her eyes, to build big fashion empire way go make her name shine well for the world. Fear full her eyes and she no know how to go about am. One day she meet a known mama T for the town way get plenty wisdom. She advice Soso to dey focus, to go fashion school, start her own fashion line. Learn business, hold on her dreams. Make she use her time well say marriage go come when e go come.

Soso take the advice, go into fashion school full time come become professional. Soso come dey popular for the town. They come invite her for a fashion show, na there she meet a man way sabi her values and no dey Threatened with success. They blend like jollof rice and chicken. You see why e no good to depend on anyone to find your dream.
Motivation - Inspiration

13/11/2023

Welcome, na trippledj I don come with anoda correct topic way go make sense with this na life.

Success fit means different thing for people but e dey important 4 everybody .
9 tips for success( No 7 na eye opener for me)
1: set clear goals; make you know Weytin you wan achieve for life. your goals and dey focused on them.
2:learn from your mistakes; no dey fear to make mistake, but when you do, try learn from am, so you fit do better next time.
3:work hard: success no dey come easy, you need put in hard work and effort to achieve your goals.
4: Network; Buikd relationship with people wey fit help you for journey to success. No be only you sabi everything
5: save and invest; make you dey safe money and also dey look for investment opportunities, e go help you secure your financial future
6: stay consistent; No dey do one main today , another main tomorrows. Consistency dey very important for success
7: No stop to dey learn new things because Knowledge na power
8: Believe for yourself and believe say you fit achieve your goals. Positive mindset dey important
9:As you dey succeed, try dey help other people wey need help. E go bring blessings to your life

Drop a 100 if you agree
Leave us a follow, subscribe if you want to dey see this videos

08/11/2023

Welcome, na trippledj na another yarns with this na life way I don come to talk about.

Jealous friend fit show some signs and e go dey important make you sabi recognise them.
8 signs your friends dey jealous of you( No 5 teach me better lesson )
1: Dem fit dey downplay wetin you don achieve and dey try to make an look small
2: Jealous friends no dey support your goals and dreams. Dem fit discourage you from pursuing your passion
3: dem go dey always compete with you fro everything like your hairstyle, dressing, the way way you waka or dey talk, when e no make sense
4:if your friend no dey genuinely happy when achieve something e go show for their face or the way dem dey talk
5: if your friend dey gossip about you behind your back , they talk bad things about you to other people just to reduce you to people. It show say na jealous friend
6: when jealousy dey play for person mind , dem fit dey avoid you to avoid confronting their own feelings
7: jealous friend sabi give compliments wey no pure like
You try sha, but e no reach my own level
8: dem dey always dey critical and dey find fault for everything wey you do, when e no dey necessary.
Person way dey jealous you, get poor self esteem

Drop a 100 if you agree with me
Leave us a follow and subscribe
If you love this video

23/10/2023

Una welcome,
Na TrippleDJ, I don come with better yans for una with This Na Life.

When you don reach 30 yrs, e dey important make you dey shine your eyes and no dey do some Jain things again way go put you for wahala. and e go give you motivation and inspiration to live your best life.

9 Things You No Need Do At 30.

1. No dey neglect your health. Make you dey check yourself, dey exercise and chop better food. Na only one version of you dey.
2. No share everything no matter how you trust your paddy friends and family. Make nobody know everything about you.
3. No dey procrastinate if you sabi say something dey important, no dey on, do am sharp sharp.
4. No dey form lazy bone, work hard, hustle for your future, no dey rely on person or expect free things.
5. No take advice from everybody who no dey where you want be for life, own your life.
6. No ever lie to yourself and no fear rejection.
7. No dey live above your means, make you no go broke trying to look rich.
8. No dey reason waiting people they think, your mental health one first before anyone.
9. No ever forget to have fun, your 30's no mean say you no fit enjoy life. Try dey find time to relax and enjoy yourself.

drop a 100 if you agree. leave us a follow, subscribe if you want to dey see this video like this.

09/10/2023

Welcome .. na tripleDj
I don come with Obonge topic way fit make sense with una with this na life.

E get better reasons to keep your life private.
Few benefits 2 keep your life private
1:you go get peace of mind. E go help you reduce drama d stress. You no fear say pipo wan judge you
2: e go protect you from evil. If pipo sabi your personal stuff, dem no fit use am against you
3: you get freedom. You fit do your own tins without fear of pipo sabi anything we y you dey do
4: e go help you focus on your personal goals and ambitions. You no go dey distracted by pipo wey wan pry into your business
5: E go make you your relationships better, you go fit build trust with people because dem go sabi say you dey respect their own privacy too
6: e go give you power to control your own narrative. How people go take see you.
7: E go make you dey independent
8: people go want know more about you when you keep things private
9: E go help you maintain your dignity and self respect. You no go dey exposed to ridicule.

Drop a 100 if you agree with me.
Give us a follow , subscribe if you love this video

click the link below to watch this video

https://youtu.be/mYA75UMCiM8

03/10/2023

Welcome..
I don come with anoda exciting topic with this na life with trippledj.
Wating I want talk about na
7Rules way go change your life
1: No listen to Wating people dey talk about you
2: Make things you no fit change go
3:growth dey take time , give am time patient because everything na small small
4: No compare your selves with others
5:Relax your self , e dey okay make you no get solution now. Life na jete jete
6: e dey on you , na you fit give your self joy , na you dey in charge of your happiness
7: smile life dey short, enjoy life and make you dey try dey grateful 4 Wating you get while you dey try to dey better.
Share and drop

If you dey serious of changing your life
Join our movement by subscribing and leaving us a follow

This is life part 6.Who you listen to will eventually affect the outcome of your life. I have created this video to insp...
05/09/2023

This is life part 6.
Who you listen to will eventually affect the outcome of your life.
I have created this video to inspire you to win.

why?
because all the world loves a winner and nobody has time for a loser. Watch this video to get inspired and win!!
click the link below to watch now

Welcome to my channel. I tell passionate stories! you will find captivating and inspiring tales that will transport you to different worlds and times.I draw...

18/08/2023

Address


Telephone

+2349024709473

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when TrippleDjoffical posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to TrippleDjoffical:

Videos

Shortcuts

  • Address
  • Telephone
  • Alerts
  • Contact The Business
  • Videos
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share