Village Square On Radio

  • Home
  • Village Square On Radio

Village Square On Radio Village Square na community wey Elders, Chiefs, Mazis, Women Leaders, Pastors, etc. all join body sit inside dey settle mata wey concern the community.
(1)

Their ogbonge leader na Madam Seke. Anywhere you dey, na there be Village Square!

27/08/2024

Village people, una good afternoon o
Na land mata wey go settle ontop Village Square today o
E get one man wey dey drag land wit person wey him sell am for o
Him been sell am 4 million 3 weeks ago and tele communication people wan come use the land and dem gree to pay 10 million but the man wey been sell am talk say na him go collect the money .
The buyer say na lie.
How we go take settle am?
Join us now ontop Village Square
Vall:0703 785 0561

26/08/2024

Village people, una good afternoon o
How una dey?
Today palava na between oga and madam.

Oga use 10 million open shop give madam make she dey manage.

oga sef just freestyle am,e no dey ask am money for anything.

Naso oga work no come dey again and him go beg madam to give am 1 million from money wey she dey make but she no gree o.

She come dey carry face give oga join.

God sef come bless oga with another work for obgodo oyibo wey excess money go dey and him never tell madam yet.
Make him carry am?

Abi make him go alone?

Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Join us ontop Village Square ontop Atlantic 104.5fm by 1pm.

Call:0703 785 0561

12/08/2024

Happy nee week,village people.
Today mata touch heart wella.
Armed robbers go couple house to go collect weting no be their own.
Naso dem see oga wife wan tinini with am but she no gree so tey oga sef Chook mouth beg am but she no still gree.
The thief dem com vex cut her 2 legs comot before dem go.
Madam dey use artificial legs and oga dey tell am to go her papa house because na her stubbornness make dem cut her legs and she dey tell am say she been keep her body for only am.
Na bad thing she been do?
Follow chook mouth ontop Village Square By 1pm
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Call:0703 785 0561

06/08/2024

Village people,una good afternoon 😊
Today mata get as e be o
One bobo talk say him and him girlfriend been plan to go vacation together and na him money dem wan take book flight, pay for accommodation and feeding.

Him come send money for flight give him babe to book the flight for 2 of them.

The girl go book for herself and her girlfriend and she no inform the bobo.

Day to travel come reach and the bobo call am and she talk say make him no vex say na she and her girlfriend dey travel.

Naso the bobo Para call the people wey him been pay for accommodation say make dem cancel am.
Him babe and her friend dey d**g reach but dem no get place to stay.

She dey call am to beg but the bobo no gree pick.
How we go take solve dis mata?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž

Join us now ontop Village Square on Atlantic 104.5fm, uyo
Call:0703 785 0561

05/08/2024

Happy new week,village people.

Today mata get to do with 2 brothers wey been dey do business together until one come kpai.

Na the senior bros been really get money for the business and the other one been dey manage am.
As the senior bros wey been get the money come kpai, him wife come hear say the husband been will some of him property give the brother wey dem been dey do business together .
She come Para so tey she arrest the brother inlaw sake of say him dey control her husband property.

Her money d**g finish and the business no dey again and she dey go beg the brother in-law to forgive am and follow support him late brother pikin for school .

Make him forgive?

Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž

Join us ontop Village Square By 1pm

Call:0703 785 0561

30/07/2024

Village people una good afternoon o
How una dey?
Today mata concern 2 friends
E get one guy wey see job opportunity online come link him friend up to apply.
Naso the friend come apply and dem pick am for the work.
Him tell am say him go dey pay am 50k every month because na him been connect am and the guy come gree.
Him d**g dey pay am for over 2 years now and dem come promote am for the work join.
Now the guy the tell am to increase the money to 100k and him no gree.
Naso him say make him follow come join the work but him no still gree.

How him go do?

Advice πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž

Join us ontop Village Square By 1pm

Call:0703 785 0561

29/07/2024

Happy new week,village people
Today mata tie gele o
E get one pastor wey go to marry for one community and dem tell am to kill goat for the girl mama and she talk say e dey against him belief as pastor wey him be.

After dem drag finish,d family come free am to marry the girl and for 3 years now ,she dey get miscarriages and her husband dey tell am say God understand why e dey happen but she dey worried because of that goat wey dem been no kill during the marriage.

She dey ask whether make sho go give dem the goat secretly?

Make she still dey wait on God?

Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Join us now ontop Village Square

Call:0703 785 0561

26/07/2024

Happy weekend,village people
How una dey?
Today kata kata na between husband and wife o

Oga talk say wen him been dey grow up,if him mama and papa get wahala wey make papa no gree chop food,him mama go call him papa people make dem come beg am before him fit chop the food.

Him come try am with him wife and madam no gree beg am and she no even send am at all.

How him go do make madam beg am because like dis him eyes d**g dey turn am.

Weting you fit advice am?

Join us ontop Village Square By 3pm

Call:0703 785 0561

25/07/2024

Good afternoon Village People.
How Una Dey Toady?
Today matter concern Church ooo.

For Church gathering, one family ask for financial assistance of 250k to treat their sick mama.

Pastor come ask church members to contribute money for the family. After the contribution, Dem realized 750k, the pastor come give them the 250k wey dem asked for and keep the other money for the church purse. Family dey vex sey pastor suppose give Dem all the money base on sey na because of Dem them do the contribution, pastor on the other hand sey but na 250k una ask for.

My people, make una help me Judge this mata, how we go do am?

Call Us On: 0703 785 0561

24/07/2024

Good afternoon, village people.
How una dey?
Today mata tie gele o
E concern couple wey things no too dey alright for their marriage.
The wife get madam wey get plenty money and she never marry .
Naso she come tell the husband to follow her madam up so that she go dey give dem money to take dey alright.
As oga and dis madam dey run things naso oga come catch feelings forget him wife o.
Now the wife dey tell am to come home but him no gree.
Oga wife sef d**g go tell her madam say na she been send her husband but she no gree leave her husband for am because dem dey in love already.
Whose fault e be?
How we go take settle dis kain mata?

Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Join us ontop Village Square on Atlantic 104.5fm by 1pm
Call: 0703 785 0561

22/07/2024

Village people una good afternoon oo.

Yes so, we Dan lap, we Dan show.

E get this sister wey Dan marry, and God come bless them as she Dan carry belle.
Onto that level, the friends of the husband come dey come come house and everything them come naso so food she dey cook.

And based on Belle wey she carry e dey stress her and after them chop finish na still she go dey wash the plate. E come even turn routine say na like that the husband friends go just dey come house anyhow. The husband for the other side no dey go other people house.

Now the wife come complain give the husband say, honey... this kind your parol dey stress me.

The husband no wan even hear, the friends still dey come.

Wife dey Para, she dey ask how she go so this one?

Calls: 07037850561 or 09079866292

17/07/2024

Village people, una good afternoon o
Today mata get as e be o
One bobo dey plan marriage with one sisi and the guy mama come sick 😫
Naso him tell him wife to be say him go bring him mama to come but she no gree.
She talk say she no fit pass through that kain suffering.
Follow chook mouth ontop Village Square By 1pm
Call:0703 785 0561

16/07/2024

Village people una good afternoon o

Make una follow judge dis kain mata o

E get one bobo wey go meet sisi say him wan marry am and the sisi talk say him go follow am go her church before dem fit marry.

Bobo come gree follow am go and dem do wedding for the girl church.

Now the girl d**g born and oga dey talk say him go do child dedication for him own church unto say na him be man of the house and the sisi sef talk say she no go gree because no be weting him been tell am before marriage be that.

How we go take settle am?

Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Join us ontop Village Square on Atlantic 104.5fm uyo by 1pm

Call 0703 785 0561

15/07/2024

Village people, una good afternoon o

How una dey?

Today matter get to do with One oga and him employees o.

The matter be say this oga get one big event like that, wey even involve to dey buy and sell tickets. Him even force them make them for buy the ticket.

After every every, him come call some people say them go work for am, come even give them which attire and hair style them go use for the event.

Naso them prepare o, him use some as usher, some as protocol and others for different work.

Event come finish na it them come dey wait make oga shake body drop something for them as them Dan work for am. Naso oga say ahh, say money no dey oo. Him no dey pay them anything.

Na there wahala dey oo.
Employees now dey Para say Oga no gree pay them.
How we wan take settle this one?

Calls: 07037850561 or 09079866292

11/07/2024

Good afternoon, village people
Mata wey reach us today involve one bobo wey been dey try do marriage with one sisi.
After him d**g do everything finish the sisi come kpai before the marriage date.
Naso the sisi papa come call am to come carry some of the things wey him been buy for the marriage.
Now the extended family members talk say make dem no return anything give am because him been don pay already.
Him no know weting to do becos him been d**g buy plenty things.
Weting be your advice?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Join us ontop Village Square By 3pm
Call:0703 785 0561

10/07/2024

Happy Wednesday, village people
Today na advice we go give one sisi for the community. She talk say she be 30 years and she d**g go school finish but the bobo wey wan marry am no too go school and him love am but her family no gree sake of say the bobo no too go school πŸ’”
Weting be your advice?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Call:0703 785 0561

09/07/2024

Village people una good afternoon 😊
How una dey?
Today mata tie gele o
One sisi talk say she d**g marry get 3 children wey be girls and her husband and him people dey worry am to born boy.naso she come carry belle again and dem go run scan see say na boy e go be.
Delivery day come reach and she come get plenty complications wey doctor talk say na 1 person life him go fit safe and her husband sign say make dem safe baby life..
She and the baby come survive and oga now dey beg am say him really dey sorry say him been no mean am
Weting be your advice?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Call:0703 785 0561

19/06/2024

Happy Wednesday, village people
E don tey o
Make una no vex say e dey like dat.
How una dey?
We d**g too miss una.
Today mata na between husband and wife o
Wife born pikin and her mama come visit dem for house make she fit take care of the baby.
Naso the guy come dey chat with him sister say him wife mama dey smell and e dey worry am make she no pass am give him pikin.
The sister come dey ask weting him expect from a village woman.
Kasala come burst when him wife go carry phone see the chats.
She dey Para say make people advice am on weting to do
Join us ontop Village Square By 1pm
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Call:0703 785 0561

22/05/2024

Happy rainy Wednesday, village people.

Today mata concern one sisi wey get bobo and the bobo tell am say him get wahala for him place of work and dem dey comot money from him salary every month.
So because of that, him come dey stay with dis sisi and na she dey provide things make dem chop for house .
One day,him tell the sisi to borrow am 150k because him sister dey hospital and dem need do surgery and him no get the money.

The sisi carry her business money give am based on say dem dey in love o

Naso message enter the bobo phone when him dey sleep and the sisi carry am come see say the bobo been add money to the 150k collect house wey him go stay with another woman πŸ˜”
The bobo sef no know say she d**g see am
How she go take collect her money from am?
Drop your comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž

Follow chook mouth ontop Village Square By 1pm
Call:0703 785 0561

21/05/2024

Happy Tuesday, village people.

Today mata na one uncle wey dey plan him wedding bring am come o.

Him talk say him been contact Dj for him wedding and dem agree price for am to play.

Him come ask the DJ if him sabi anyone wey fit do decoration for am and the guy come connect am to one sisi wey him sabi on Facebook.

Talk led to talk naso the sisi go dey ask the guy how much the DJ been charge am and as the guy tell am,she come dey discourage am say the money too much πŸ€”, come dey advice the guy say she get another dj wey fit collect less.

The bobo dey wonder which kind thing be this, na like that him dey ask weda make him tell the dj wetin the girl talk abi make him drop the DJ carry another one or make him drop the girl.

Like this him no trust anybody again, make them no for go scatter him marriage give am sake of poor planning.

Calls: 0703 785 0561
Follow drop your comment, we go read am.

20/05/2024

Village people, happy new week o...
How una dey alright?

We Dan show ehh.
Today e longi as e Dan reach level wey person no fit talk again.

The tori be say e get this marriage wey suppose happen on the 23rd, like this e Dan shutdown.

Why? Now the best man of the groom been dey camp for the same lodge wey this suppose wife dey stay and onto that level, the best man Sabi all the kurukere Waka wey this aunty been dey do that time.

This best man sotey himself use style take chop wetin him no suppose chop. (You suppose understand) 🀣. Him come dey recommend this aunty give some people, e reach that level.

Na like that this Bobo tie mind go tell this groom all the tori about this aunty, groom hear tori come dey devastated come Scatter marriage o, say him no dey do again.

Like this, aunty no wan chop food, sleep na so so cry dey her body. And on the other side the groom and best man dey onside dey ball life, lol.

How una see this one?
Wetin groom do e nice abii e no nice?

Choke mouth, make we for see how we go resolve this one.

Call: 07037850561
Follow drop your comments, we go read am.

17/05/2024

Happy weekend, village people
Today mata na Sana mmi yak o
Husband visit wife for office early momo to go Ling for there.
Naso madam no gree o based on say na the same house she comot go work and office na official place.
Oga come vex drybtry force am and she come shout and people come open office see weting dey sup.
Oga vex comot ring throway for ground and him never go back house till today .
Madam dey ask weting she go do make her husband come back house.
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Follow chook mouth ontop Village Square By 3pm
Call:0703 785 0561

16/05/2024

Good afternoon, village people
How una dey?
Today mata na one sisi bring am come o
She talk say her husband to be tell am make she no go school after marriage because of plenty stories wey him dey hear about women wey go school for their husband's house and dis sisi really wan go school .
She don write jamb score high and the man talk say if she really want go school make she forget the marriage.
Weting you fit advice am?
Follow chook mouth ontop Village Square
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Call:0703 785 0561

15/05/2024

Good afternoon , village people
Make una follow judge this Mata o
One church bobo beenbtravel from this community to go do something for another community and him no get anybody for that side.
Naso him go hin church to go sleep but dem no gree open church for am even after him d**g show dem evidence say na that church him dey go.
Now the bobo talk say him no fit go that kain church again and him church pastor dey tell am to forgive.
Wetin you fit advice πŸ™„
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Follow chook mouth ontop Village Square now
Call:0703 785 0561

14/05/2024

Happy Tuesday, village people.
Today mata get as e be o
E concern couple wey dey plan marriage and the wife to be talk say if the guy no comot from him family house before the wedding go rent house say she no go continue with the marriage πŸ€” πŸ™„
The guy sef dey explain give am say him go rent house one year after marriage because the family house dey close to him work place and him parent need am around because na him be only son butbthe girl no still gree.
The bobo dey confused and him no know weting to do because him love the girl and him love him parent too.
Weting you fit advice am?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Follow chook mouth ontop Village Square By 1pm
Call:0703 785 0561

09/05/2024

Good afternoon, village people 😊
How una dey?
Wahala dey o
Man call off him wedding because his wife to be been go comment for post on social media.
She comments say if her husband cheat on am, him go train another man children because she go follow cheat carry belle. Na the husband to be brother see the comment come tell the guy and the girl now the beg say she been no mean anything wey she been write say na normal social media write up e been be.
Weting be your advice?
Join us ontop Village Square By 3pm
Call:0703 785 0561

06/05/2024

Happy new week ,village people .
Today mata tie wrapper o
E concern 2 sisters wey their parent been kpai .
One of dem marry but she no fit born give the husband na hin she go beg the sister to come dey with her husband born for dem.the sister no been gree but she beg am till she come gree.
Naso her sister come born twin for her husband and she dey tell am to keep the children for am go because her husband dey give her more attention pass am.The sister sef dey talk say she no fit go because na she born the children.
How we go take settle this kain mata?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Join us ontop Village Square By 1pm
Call:0703 785 0561

30/04/2024

Village people, una good afternoon oo..

Hope say the sun never dey hammer you too much?

Today matter ehh.

So e get this couple wey dey together, everywhere been stew so as this economy come be, the husband come say make the wife no dey put meat for food again sake of say things cost, make them for dey manage.

Wife gree based on say she be understanding wife. Naso wife say make she go do small washing na like that she go see receipt of fast food wey the husband dey chop outside.

Na like that wife Para oo, and them even get small pikin for house, e come be say this pikin sef fit no get protein for body.

How we wan take settlement this one?

Call: 07037850561 or 09079866292
Or make you for drop your comment we go read am.

29/04/2024

My village people una good afternoon oo!
Happy new week!

Today matter tie gele oo.

E get this relationship wey this aunty dey and so far them Dan dey date they, everywhere stew and sweet for them. Them Dan even do introduction and marriage plan dey on track sef
Along the line, the guy mama come sick, naso them diagnose am with Kidney failure. E reach stage wey them come dey find who them go get kidney to do kidney transplant for.
Las Las them find out say na this aunty and their last born. Aunty say sake of say she dey love say she go give the mother in-law to be her kidney. Na like that the girl family say them go swear for the girl if she try am. Say them no even sure say this guy go marry her. Say make she stop that nonsense!

Wetin this aunty go do?
Make she continue or make she hear wetin her family dey talk?

Calls: 07037850561 or 09079866292

26/04/2024

Happy weekend, village people
Try dey chop small.life make life no chop you.
E get one broda wey been borrow money from him friend and him no return am.
As him friend begin dey worry am for him money, him beg am say the money no dey to give am but him get get game wey him dey sure say e go play make that him friend play am and if him win make him take the money wey dey involved.
Naso the guy go play the game win 10 million and money wey him friend been owe am na 200k.
Now him friend dey him dey drag am say make him collect him money give am the balance.
The broda dey talk say make dem share am 50 50 but the guy no gree.
Weting you fit advice them?
Comments πŸ‘Ž πŸ‘Ž πŸ‘Ž
Follow chook mouth ontop Village Square By 3pm.
Call:0703 785 0561

Address


Telephone

+2348088203109

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Village Square On Radio posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Videos

Shortcuts

  • Address
  • Telephone
  • Alerts
  • Videos
  • Claim ownership or report listing
  • Want your business to be the top-listed Media Company?

Share