Community Yarns

Community Yarns All tory and gossip from our domain and backyard told for our own ogbonge language.

My pipul we dey hear now say Mark Zuckerberg don do operation for im knee. Oga Mark Zuckerberg, wey establish Meta (wey ...
04/11/2023

My pipul we dey hear now say Mark Zuckerberg don do operation for im knee.

Oga Mark Zuckerberg, wey establish Meta (wey bi Facebook bifor bifor), don do operation for di wunjor im get for im knee ontop di training wey im dey do to prepare for one gbas-gbos fighting competition wey go happen soon.

Zuckerberg bin share dis tory ontop im Instagram post on Friday.

Na plenty grammar wey in write for di post be dis: "I am on the road to recovery.

" Zuck tore my ACL sparring and just got out of surgery to replace it.

"Grateful for the doctors and team taking care of me.

"I was training for a competitive MMA fight early next year, but now that is delayed a bit.

"Still looking forward to doing it after I recover.

"Thank you to everyone for the love and support."

Abeg make we wish Oga Zuckerberg fast fast healing.

Credit: Instagram | Zuck
-----
Follow us for more tory ontop politics, sports, entertainment and others.

I wish everydodi beta November.
01/11/2023

I wish everydodi beta November.

03/01/2023

My pipul I welcome una for dis new year. E go beta for all of us dis 2023.

My pipul as be now say Messi don finally win World Cup, even though say Mbappe bin wan pour sand sand for Messi garri ma...
21/12/2022

My pipul as be now say Messi don finally win World Cup, even though say Mbappe bin wan pour sand sand for Messi garri make we dey congratulation him.

Twale for the ogbonge GOAT.

My pipul how una see dis achievement wey Messi and Argentina don get so. Sbey you go still dey debate who de real GOAT be again?

ICPC don gbab our fine boy singer, Oladapo Daniel Oyebanji wey im Street name na D'Banj. Dem arrest him sake of say im h...
07/12/2022

ICPC don gbab our fine boy singer, Oladapo Daniel Oyebanji wey im Street name na D'Banj. Dem arrest him sake of say im hand dey for kurukere waka on top N-Power money wey miss road.

De Independent Corrupt Practices Commission (ICPC) wey be join bodi wey dey torchlight criminal mata for we kontri don confirm say dem arrest D'Banj true true. ICPC tok tok person wey be Mrs. Azuka Ogugua tok say D'Banj dey dem cell dey chill as im dey help dem to name other pipul wey get hand for the money wey miss road.

As e be so, we here say na pipul wey suppose collect the N-Power money wey no see am collect, na dem write petition go give ICPC so come mention D'Banj name on top plus plenty oda politicians. Na dis one come make ICPC pipul come invite D'Banj come dia kabaa. Na on Tuesday 6th December, 2022, na im de bobo go answer dem call but dem no gree make im waka go back im house, dey just carry handcuff, padlock and chain take tie him come push him inside dem small room lock am carry key trowey.

N-Power na Federal Govament program wey dem say make graduates wey neva get work take dey hold bodi. De program dey im third part like dis.

My pipul how una take see dis mata so? Shey D'Banj neva fall our hand like dis?

"My papa bin talk say I no go become useful for life, throw me comot for house" Chiamaka Nnadozie.My pipul dis na de sho...
06/12/2022

"My papa bin talk say I no go become useful for life, throw me comot for house" Chiamaka Nnadozie.

My pipul dis na de shocking tori wey Naija Falcons goalie bin yarn for one interview wey she do with amebo pipul. She talk say im papa bin no like as she wan dey play football, he tell her say make she go learn anoda hand work but she refused say na ball she wan to play.

Na dis her strong head na im come provoke her papa wey make him pursue her comot for house, come talk say she no go become somebody for life. Dis mata tire her sotay but she no give up. She make up her mind say go hustle to become somebody. She tok say she don make up her mind say if she reach 20years and never make am, say go go back go beg her papa like prodigal Pikin.

But as iyanu come shele, God pick her call na im dey call her to play for Naija Falonets under-17 wen she dey 15years. Na from dia her luck begin shine dey go sotay her papa come see her for TV, de tin sweet him body wey make him come take her back as im Pikin.

Chiamaka Nnadozie wey dey 21years old now, dey play for Paris FC inside France Feminine Division and for Naija Women wey be Falcons.

My pipul how una take see dis kain tori wey Chiamaka don yarn so?

05/12/2022

My pipul una good morning. Make dis week beta for una.

My pipul na two lions wan meet for world cup quarter final dis night. De Three Lions of England and Senegal, The Lion of...
04/12/2022

My pipul na two lions wan meet for world cup quarter final dis night. De Three Lions of England and Senegal, The Lion of Teranga.

We go know the lion wey strong pass for dis game today. One lion go kill one chop.

My pipul which lion so survive, England abi Senegal?

My pipul as e dey hot Lionel Messi and Argentina don jump enter de Quarter Final of de 2022 World Cup wey dey shele for ...
03/12/2022

My pipul as e dey hot Lionel Messi and Argentina don jump enter de Quarter Final of de 2022 World Cup wey dey shele for Qatar as dem beat Australia 2-1 for dem round of 16 game.

Na Messi score de first goal for 35-minute inside the game. Alvarez score de second goal for 57minute before village pipul come make Fernandez E wey be Argentina player dash Australia 1 own goal for 7 7-minute. God save am say Australia dey play igbakugba so dem finally win de match.

For another match wey dem play for afternoon today, Netherlands hammer USA 3-1 take enter for quarter final. As e be so, USA and Australia don dey pack dem ngwongwo into dem aeroplane to take tell Qatar and 2022 World Cup bye-bye.

My pipul how una take see dis world cup? E be like Messi and Argentina go reach final like this. Wetin una think?

IMPORTANT UPDATE:My pipul, na important infomate na im be dis so wey dey comot from the office of INEC the join bodi wey...
03/12/2022

IMPORTANT UPDATE:
My pipul, na important infomate na im be dis so wey dey comot from the office of INEC the join bodi wey dey take care of election mata for we kontri Nigeria.

INEC don come aside, carry microphone and amplifier dey yarn say evribodi wey register for new voter's card abi the pesin wey do voter's card transfer, make all of una prepare like person wey wan go run for Olympic games. As e be say from 12th December 2022 go reach January 22, 2023 dem go begin dey evribodi im voter's card.

INEC don draw hand for ear give evri citizen say, make evribodi go collect im voter's for dat period as dem no go listen to anybody wey go say "I neva collect, I neva collect" afta dị period wen dem give.

De one wey sweet pass for dis imformate wey INEC yarn so be say dem go dey give pipul dia voter's cards even on Saturday and Sunday so dat nobodi go get excuse say work mata no gree am make e go collect im card. Time to go collect this card every day na from 9 O'clock in de morning go reach 3 o'clock in de afternoon.

My pipul how una take see dis INEC update so, you like am abi e no sweet you?

03/12/2022

My beta pipul una happy weekend. Happy December and happy Christmas for front.
E go beta for all of una this jolly season.

25/11/2022

My pipul una good morning. Na Friday we dey so.

Make Oluwa God bless una yanfu yanfu today.

24/11/2022

My pipul no be small something dey shele for de 2022 World Cup wey dey happen for Qatar so.

Na so so breakfast and hot lunch na im dem dey serve give some big big Oyinbo teams. The breakfast begin with Argentina as dem collect 2-1 wotowoto lunch for the hand of Saudi Arabia. Hmmmm, Argentina oo wey Messi be dem captain, and wey be among de kontris dem wey we dey say go win de world cup.

As we still dey digest dat wan, na im another big kontri wey be Germany collect dem own bulala from di hand of Japan. Dem too chop 2-1 like Argentina.

My pipul, how una take see dose games so? You tink say Argentina and Germany go still perform well for dis world cup so.

24/11/2022

My pipul una good morning!
Make today beta for us and make plenty money kiss our bank accounts today.

I just predicted the latest outcome of the Football 2022 on LetsChat. Try Lifie (Life with selfie) to predict & win big!
24/11/2022

I just predicted the latest outcome of the Football 2022 on LetsChat. Try Lifie (Life with selfie) to predict & win big!

23/11/2022

My pipul, una welcome to to this ogbonge page.
For here we go dey Sama you beta yarns from our dem communities for Pidgin English.

Address

Sango Otta

Telephone

+2348068758292

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Community Yarns posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Videos

Share


Other News & Media Websites in Sango Otta

Show All