03/08/2022
If Egypt was in Port-Harcourt π³π³ππ
Portipher's wife: Joeboy lap!
Joseph: Maley, watin sup?
Portipher's wife: Joeboy, u wan cap me say u no dey see say my kpekus dey drip for youπ
Joseph: Tarrrrrrh, disembark from dat careless capping. On how senior man lap d unit con kporr me on top ur kpekus Maley, na blood over stain o
Portipher's wife: U dey Jones..? See dis smaller o. On how I dey set compass give u make u for taste watin ya senior man dey enjoy, u dey cap vertically. Joeboy u dey fear..? Ur liver no strong..ππ
Joseph: Maleeeey, based on spiritual things and things make I cap u. Em say give watin belong to ceaser to ceaser. Ur kpekus belong to my senior man and me Joeboy, no get doings for dat kine matter
**Joeboy walks away while portipher's wife pretends to be sobber and shed fake tears**
Portipher returns and met her in that state.
Portipher: Banney wida naa? Na wetin make joy soap no come on board?
Portipher's wife: No be ur boy Joeboy..., Upon all the bannies for d unit, Joeboy swear say na for my kpekus him wan chook him rod π©π©
Portipher: Joeboy lap!!!!!ππ
Joseph: Senior man, wida wetin sup?π³
Portipher: Joeboy, u wey I carry from street, make I rise you, make ur future for fine,, u don dey do do, dey jump jump, dey clap clap, dey shake shake waist for where my banny deyπ€₯
Joeboy: I no comprison ur caprisone. Cap me the legitπ
Portipher: My bannie cap me say you been wan chop her kpekusπ‘
Joseph: Ahhhhhhhhhπ senior man, d person wey play u dat tape, him shoe no shine and him face no showπ©
Portipher: Esssssssssss, where you? You dey try tell me say i dey cap vertical? On the zero zero hour, I go jazz you down, put am for ur body wotoporiously you no go fit shout die it. I dey send u go SS3 boys hostel ngwa ngwa
Joseph: Ahhhhhhhhh! Senior man sympathyπ©
Portipher: Where you? Die it π π€₯ Infact Jazz out
π€£π€£π€£π€£π€£
GEN SHAM OZI VERE VERE βοΈβοΈ
cpd