10/08/2022
Scientists dey track one new virus wey come from for eastern China as dem report say e don infect at least 35 pipo.
Dem find di Langya henipavirus (LayV) wey dem dey call ‘Langya’ for patients for di Shandong and Henan provinces. Many of dem bin show symptoms like fever, tiredness and cough.
Researchers don sabi say dem dey find di virus mainly for shrews, plus say even as infection don show from animal to human beings, dem neva find evidence say LayV fit transmit between humans.
One of di researchers, Wang Linfa from di Duke-NUS Medical School for Singapore, tell China state-run Global Times say di cases of LayV wey dem don find no dey deadly or very serious, so nobody "need dey fear".
But oga Wangsay e sha dey important pipo dey alert as plenti viruses wey dey for nature get some kain results wen dem infect humans.
LayV na type of henipavirus, wey be category of zoonotic viruses wey fit jump from animals to humans.
Di United Nations don warn di world before say dem go see more of dis kain diseases as dem dey increase exploitation of wildlife and climate change.
(📷 Getty)