Naija Pidgin Promoter

Naija Pidgin Promoter Naija pidgin na im all of us dey blow for Nigeria. Na im make us be Naija. Na our every every.

The pidgin Class Initiative

Former columnist NAIJA LANGWEJ A-Z (LEADERSHIP Newspaper, Abuja-Nigeria)

Today na yesterday future: We dey invite you to attend dis program where we go yan about Naija Pidgin. Abeg, try to atte...
04/03/2024

Today na yesterday future:

We dey invite you to attend dis program where we go yan about Naija Pidgin. Abeg, try to attend or tell someone to attend. Come mek we yan.

31/10/2023

ME AND MY FRIEND

ME AND NY FRIEND na title wey I don give di book wey I don dey write scatter for difren-difren place, even though sey, I don already put some of dem for some of my books. Na Naija Pidgin go plenty pass for inside ME AND MY FRIEND. Dat mean sey, small English go dey inside ME AND MY FRIEND.

If ME AND MY FRIEND enter your hand, you no go wan drop am bikos e go mek you laff and laff but you go pick sense wey you fit use. Everything wey you go read for ME AND MY FRIEND na wetin don happen and no happen between ME AND MY FRIEND.

ME AND MY FRIEND na book wey go carry plenty reality plus sey, Amebo na Chairman wey tek head carry everything. Why i dey write wetin I write so, na to beg you mek you watch out for ME AND MY FRIEND with your full chest. E konsain ME AND YOU plus YOU AND YOUR FRIENDS. Na about YOU and WE, plus WE and YOU.

Eriata Oribhabor
Lagos, Nigeria

28/08/2023

Dat Thing...

tell me something, anything,
dat thing wey be everything
di plenty times and dat thing
wey mek you dey catch fire.

tell me wetin you no wan hear
and di area wey you no dey fear
like water, like river and dia lyrics
how water no dey touch your body.

tell me about you, and your band
from yonda you still hold ground
and dey play well for every land
na your good hand I wan see.

tell me about di top of mountains
and how water tek dey siddon on top
but free me wen we reach di very top
lines g*t chop up with mountain rain.

tell me something, anything
dat thing wey be everything
di plenty times and dat thing
wey mek you dey catch fire.

Eriata Oribhabor
Lagos, Nigeria

18/05/2023
POETOURISM 2023Wen you rest your body for tree wey don reach 445yrs old, na wetin you go dey imagine? Which inspiration ...
18/05/2023

POETOURISM 2023

Wen you rest your body for tree wey don reach 445yrs old, na wetin you go dey imagine? Which inspiration you go fit get?

ERIATA 30@60 FOR WARRIWen me and di former chairman of ANA Lagos,  Comrade Poet Dagga Tolar agree sey na "The Art of Men...
17/05/2023

ERIATA 30@60 FOR WARRI

Wen me and di former chairman of ANA Lagos, Comrade Poet Dagga Tolar agree sey na "The Art of Mentoring for Literary Sustainability" go be di topic wey dem go tok put for my book launch wey go take place for Lagos, Abuja and Warri, our mind join say, na di best decision we take, especially as na for program wey konsain me. As we kom tell our own big oga dem for book mata like Professor Niyi Osundare, Ismail Bala of BUK Kano and Professor Sunny Awhefeade of Delta State University wey deh for special "sabbatical" now for Delta state university of science and Technology, Ozoro, di three of dem say, na correct topic.

For dis Saturday wey be 20th May 2023 for Waffi, na own Professor Sunny Awhefeade go tok for di same topic wey I mention before.

Bikos Eriata Di POET na proper Warri boy, im belle jus dey sweet am sey, big big book pipul kom accept to tok put for di topic about "mentoring" for im book launch program.

Eriata Oribhabor
Naija Pidgin Promoter
Warri, Nigeria

05/04/2023

ME AND MY FRIENDS

ME: Long time o o. You dey so?
Wetin dey happen for your side?

MY FRIEND: I deh like sey I no deh.
I dey where you keep me.

ME: Na wa oo...
If you deh where I keep you, I for dey see you na. You travel?

MY FRIEND: Abeg, I no wan tok poetry dis night.
Na where you keep me I still deh.

ME: Okay, abeg no vex. I don understand now.
I go com where you deh to see where you kom deh.

Eriata Oribhabor
Lagos, Nigeria

"MY BOOKS UNVEILING EVENT FOR LAGOS" By God's grace we go join hand show dis books to Nigeria and di world on 22nd April...
05/04/2023

"MY BOOKS UNVEILING EVENT FOR LAGOS"

By God's grace we go join hand show dis books to Nigeria and di world on 22nd April 2023 for Lagos. Na proper record of wetin I don dey do with our Pidgin since 2011. Every book here correct and every person wey want mek our Pidgin belong well go need get im own book.

1. Abuja na Kpangba and other poems
2. If You Hear Sey I Deh Prison
(Ed. anthology of poems)
3. Mek We Yan (Notes for Naija Pidgin and English)
4. One Leg Forward, Two Leg Backward (Prose)
5. ONE FOR DI ROAD (poetry.prose.plenty things)

Plan to grab your own copy.

Eriata Oribhabor
Lagos, Nigeria

TEA AND COFFEE DON ENTA LEVEL -1Na two days ago man-pikin tell imsef sey e must romance dis portable machine wey dem dey...
06/03/2023

TEA AND COFFEE DON ENTA LEVEL -1

Na two days ago man-pikin tell imsef sey e must romance dis portable machine wey dem dey tek do tea and coffee. Machine wey man buy since 2019 dey look man, man dey look am. Na di second house e don follow man pack enta. If sey e fit tok ehhn, e for don tell man-pikin to return am to where dem buy am and true-true, if you consider di kain dust wey im carton don chop, you go sorry for am. From one house to anoda, na clean clean don dey tek head carry everything and for long time now, di real mata na to get courage and time to open carton and see how e be for inside carton. Meanwhile, you know how e dey be naaa. Man-pikin wey grow up with kettle and stove, den gas burner and kettle for hot water and tea level, kom say na Oyibo style e wan do, to prove sey, di like wey man-pikin like tea pass like, na love. How man go get time settle down open carton do wetin im sopoz do kom be war. Atimes, man-pikin go dey ask imsef weda na force dem force am to buy di machine. If na now wey dollar cost like wetin kol, wetin person go dey do with machine wey di money wey man-pikin tek buy am don reach to pay house rent? But mek e no be like sey na old level wan win today level, na so courage summon imsef enta man-pikin body, sotey, man cross kettle bridge enter land of tea and coffee machine. No be small thing o. Na so di real story wan start.

*Dis story get belle...

Eriata Oribhabor
Promoter, Naija Pidgin

28/02/2023

I NO BE SPOKEN WORD POET. I JUST READ MY POEM BECAUSE I WANT MEK YOU GRAB DI MIC. SAY YOUR MIND. NA Genti Media PACKAGE AM. CLICK TO WATCH.
https://fb.watch/i_3bwckv3z/

FOR DI RECORDTHE MARKET MAGAZINE ABUJA - 2009Na for here I start to write and promote Naija Pidgin since 2009. Na Chamba...
27/02/2023

FOR DI RECORD
THE MARKET MAGAZINE ABUJA - 2009

Na for here I start to write and promote Naija Pidgin since 2009. Na Chamba Simeh and Julius Ogar be Editor and Associate Editor by dat time.

Born Throway na curse deh for my book:
MEK WE YAN.

So, no be today we don deh di matter.

Address

Surulere, Lagos-Nigeria
Lagos

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Naija Pidgin Promoter posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Business

Send a message to Naija Pidgin Promoter:

Videos

Share