
13/04/2025
CAVEAT EMPTOR: MTN DEY RIP NIGERIANS THROUGH DATA!
My people,
Make we talk true — this thing don too much!
MTN don turn big scam for this country. How person go buy data with him small money, and the thing go just vanish like breeze? Even when you no dey watch video or do heavy browsing, data go just dey disappear. Na who dem dey deceive?
Everyday dem dey chop our money through data way no dey last. 6GB data no fit last two days again! Wetin MTN dey use the data do? This one no be bad network — na pure daylight fraud!
To make am worse, our government under President Bola Tinubu just dey look. People dey suffer, data dey vanish, fuel price don go up, and now we no fit even browse in peace.
We don tire!
We dey call on:
NCC make dem investigate MTN and their data cheating system.
Nigerians, make una speak up! Post your story, share your experience.
Use these hashtags:
This wahala don reach neck. We no go quiet again.
MTN, we dey see una! Government, we dey watch una!
We deserve better, and we go fight for am.