
30/01/2025
Today 4 ontop wit Dicto and Bidibombo,
Na one man bring mata come o he say eim Na business and eim wife dey do federal government work and her income pass eim own, Na court marriage dem do dát year and dem don get 2 children and she dey support d family but eim wahala wit her be say eim wife dey drink alcohol well well so tey she go forget hersef and sometimes she dey vomit full bed. And he no bin see her like dat b4 he dem marry dat year.
Now sef him dey suspect say she dey sleep with small small boys if she don high. He don talk to her taya he don even report her to Dia parents but she no still stop. He say she dey make eim shame always say him dey think to divorce wit her but he no no wetin go come out if him do am
Abeg make una advice am on what to do wey him family go still safe.