
23/12/2024
Court don close for vacation on Friday. If dem catch you now, just know say na next year you go see outside🥺! You fit chop Christmas rice and New Year chicken for cell o🧑✈️! Abeg, behave yourself, avoid wahala/trouble, and if person wan drag matter, just waka dey go. If person step on you, say sorry join. No go do “big man” for road, ooo😜!
This period no be time to flex big man or form stubborn. Stay low-key, waka jeje, and secure yourself ooo😊! Wahala no dey ever finish, so no go look for am. Stay safe ooo!