14/01/2025
Join The BISHOP OF AYAKATA MINISTRY Inside PIDGIN MOTOR On Top Your Kakalicious Program "HOW YOUR MATTER BE"????
Aguuuudmorninng...To You Kpokolicious Kontri Man And Woman Inside This Tuesday Tear Rubber Monica...
Hope Say Una Day Don Dey Waka Dupe Well ni??
So For Inside "HOW YOUR MATTER BE", One Tenant Wey Be Okada Man, Don Impregnate Em Landlord Two Daughters, One Is 20years And The other One Is 22years. And Na The Only Two Pikin Wey That Landlord Get.
Na Their Mama Find Out Say Her Two Pikin Don Get Belle, And She Come Ask Them One After The Other, Secretly ..The Two Daughters Come Talk Separately Say Na That Their Tenant Wey Dey Ride Okada...As The Two Girls No Come Know Say The Brother Okada, Dey Kolombi Two Sisters..
Their Mother Now Don Go Confront The Brother Okada, And Em No Deny Am,
The Woman Now Dey Ask Una, Wetin She Go Do, As Her Husband Wey Be The Landlord Never Hear About The Matter???
Make Una Advise Am...How She Go Fit Handle The Situation, Make She Tell Her Husband Abi Make She Hide Am From Am, Abi Make Them Find Way Comot The Belle As E Still Dey Fresh So?
Still Telecall Us @
090-1000-1991
090-6910-7777
To Follow Chuk Mouth.